Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: Abiodun on May 09, 2019, 07:23:54 PM

Title: Facebook don Softens Policy on Crypto and Blockchain Ads
Post by: Abiodun on May 09, 2019, 07:23:54 PM


Over one year after hin outright ban, Facebook don further lift some restrictions on cryptocurrency and blockchain related advertisements. For an updated policy announced yesterday, the social media firm said ads involving blockchain technology, industry news, educational content or events related to cryptocurrency go no longer require prior written approval
Title: Re: Facebook don Softens Policy on Crypto and Blockchain Ads
Post by: Fivestar4everMVP on September 23, 2020, 12:15:08 PM
How they no go soften am,?
Dey don see say nothing wey dem do go stop crypto from going up, even self, dey come realize say na them go dey loose money self cus all the money wey dem dey see collect from all this advertisers, they no dey see am again. That's why they deside to lift the ban.... Na mumu dey worry them
Title: Re: Facebook don Softens Policy on Crypto and Blockchain Ads
Post by: Sammy9ce on March 01, 2021, 10:18:55 PM
Currently now I no sure oh, cause I just add for my status say I wan buy btc who get for sell DM. Na so den rush restrict my Facebook account for 7 days no comment or like or post. The thing just tire me.
Title: Re: Facebook don Softens Policy on Crypto and Blockchain Ads
Post by: nelson4lov on March 22, 2021, 05:05:49 PM
Currently now I no sure oh, cause I just add for my status say I wan buy btc who get for sell DM. Na so den rush restrict my Facebook account for 7 days no comment or like or post. The thing just tire me.
Seriously? 7days restriction for Dat small talk?, omo Facebook policy Don dey way worse than before, this days common to tell person "f*ck you" them go give you restriction sharpaly, na my issue with all this social media's now, dem too dey centralized and very strict, I wonder why them dey do like that sha, e dey irritate me like this Twitter sef Don tire me, you post  some crypto stuffs boom suspension.