Introduction
As I wake up this morning at about 2am, wich e dey quit earlier than usual, I realize say na de same country i still dey and nothing don change. As per-say today na Wednesday, na definitely another day to hustle tight bcus nothing dey funny again. Mak i no lie 4 u, inflation dey really tell hard on de piple. Our currency no just get value again. Truth be told my piple, things are not getting beta in terms of national progress. We definitely dey survive unto say most of us dey bless with de grace to survive under tough circumstances. Assuming say na US all dis things 4 dey happen, person fit just do rubbish to em self bcus say milk no dey fridge, or bcus fuel 2 cost.
If u actually dey region wey 24hrs light dey, dat means u dey live under grace. Ideally, nothing suppose concern light concern wi country due to how we are being treated. Though, i no 2 understand how de light distribution thing dey work, so i no go blame anybody, but trust me, we all as citizens no suppose dey live 4 inside darkness. Christmas don reach again, unto say na de only time 4 some certain families to still enjoy dem selves, maybe na postpone dem go do due to de hardship.
Hardwork
De reason why i title dis write up 'Almost Everybody deserve a beta life 4 wi country', na bcus i understand de fact say no b everybody dey hardworking. If no b everybody dey hardworking, den i no sure say everybody go fit live beta life looking at de present circumstances on ground(inflation). I dey always appreciate piple wey dey very hardworking, most especially de committed ones. Na why i no dey jealous any man wey dey enjoy em money, bcus i clearly understand hw e take suffer.
One of de most saddest thing na wen person dey work hard, but e no dey get beta reward 4 em hardwork. De mata dey stressful. How de person go even possibly meet de needs of em piple 4 hux ?. Na de country wey we find ourselves.
Another interesting part na those wey dey work hard, but e b like say dem dey work smart. Na those ones dey get am clear, most especially 4 dis era of technology and remote jobs. Dem just take full advantage of de internet, by learning de necessary skills 2 make a living.
Wich ever category we fall put, de inflation still dey affect us in one way or de other.
Crypto
I no fit just tink of de unimaginable blessings wey dis project don bring 2 d life of so many piple, especially 4 dis country. If not 4 crypto, I guess large percentage of de youth suppose don dey do watin their mate dey do. Mak i no talk spoil, bcus i 4 say: dem introduce Bitcoin 4 naija piple sake. I remember my last post here, were i share: 'why crypto take be beta back-up'. I gat share am bcus i experience de situation myself.
Mak i no lie, bitcoin and others don really help us as Nigerians in one way or de other. Especially wen we dey in situation where all man dey 4 em self. Youths wey never even reach 25years don dey hold millions 4 account without their parents knowing. The money wan b like free money, but it is not actually free.
Real Truth
From every thing wey i don dey write dey cum, e go make sense if i conclude with something interesting.
"Dem dey talk am say: All fingers are not equal", and na de real truth b dat. Reason na bcus say: 'no b everybody go dey rich, no b everybody go dey poor, no b everybody go do remote job, no b everybody go wan work hard, no b everybody go wan work smart, no b everybody go dey involve 4 crypto' and 'no b everybody go use internet'. Na de real truth just b dat. Many piple dey rich 2day through programming, while others na through crypto, or through working for someone.
As per-say na naija we dey, no body care how u take make ur money, but u must consider chosing de right part. If almost all of us here trust de crypto process so much, den fine, but just know say about +200M piple trust other process. Just find watin go work 4 u so dat u go survive.
In conclusion
Every day na another opportunity to give a try. Every day represents a step forward no mata hw de process slow reach. Sometimes, we fit slip from great opportunities, but just know say a beta one dey ahead of u. Na 2 go find am, and finding it isn't that simple. Do de best u can 4 others, no do pass ur power bcus 'Almost everybody deserve a beta life 4 wi country'.
Have a blissful day ahead.
To b continued...