Omo the unemployment rate for Nigeria too much wetin sef joor , including a large youth population, a lack of job opportunities, no investment in education and training. This country na where we dey go sef, Nigeria economy depends on oil and gas sector, wen dey hard for global sector. As no job so many people dey struggling to find work so them fit chop .you know any possible solution wen dey my people, from the past 8 years now we dey hear change change not even one improvement sef na hard the country don hard like this. Who put am for mission impossible? Most time sef you go read some course sef no job for that course for the country example biochemistry no work person go graduate nothing come out you go still go back farming. This thing when dey happen now dey make many people no like go school again, them look education as trash now. The situation don make many responsible youth join arm robbery, kidnaping, yahoo, and many fraudulent activity so. Nothing our government don talk about this, everyday more people dey finish school no work even to increase salary na problem Nigeria as e dey so the wahala plenty. If you no go you no go know.