1
Nigerian Languages / Re: Farming airdrops
« on: May 25, 2024, 10:26:51 PM »Na today? Because when they launched am for di 14th of this month many people/investors dey complain say di coin na waste of time and project company sef come announced say dem go stopped di deposing of the.coin in the exchange until di 16th of dis month.and dat go be today. So I believed.say if people get gain from the token den that go be today wey dem finally launched am to all the qualify exchanges. Well we thank God for them wey make am from dat token because many people been dey fear.When Notcoin came out, ah people dey mined am serious and when di announcement came say dem want launched am for exchanges na there the real hustle start but at di end nothing come out and finally it is suspended till 16th of this month. I never mine and farm airdrop before.It is all over X, the testimony of some people who claimed to have benefited from NOTcoin airdrops.
To all those people wey dey lucky to gain from the airdrop because nor be all airdrops dey legit, many na fake and waste of person time. I happy for them because e dun give dem small money wey dem fit use to start to invest in other better cryptocurrency wey dey.
I never actually hear anything like say the team been want to change the coin or so. Wetin I hear be say dem go list this month for exchange which dem do and to be frank people really pop champagne for the notcoin matter. Bois hit Maga big time but now the price and market cap of the coin don drop low. I still never hear the team talk anything about the price drop which we all know say Na normal but make we just assume say that Na price corrections dey go on so which means investors can bag more.