For me sha, the whole thing just dey tiring, most especially the high cost bitcoin transactions fees, na this one dey pain me pass, because when it comes to naira scarcity, this one dey very easy to cope wit for my area here since several businesses now have POS machine, even some market women now get POS machine, so this one no dey too pain me, as sometimes self, I fit dey for house for like 2 to 3 weeks and no single cash go dey hand, but me and my family go still dey chop normal normal, plus do other expenses as well.
But when it comes to this bitcoin transaction fees, an em dey pain me pass, last week, I won withdraw $100 worth of bitcoin from my account, I have to spend like 8k naira for fees, omo, after I check wetin that 8k for do for me, I begin dey feel like person wey loss money wey him no plan to lose to gambling.
Anyhow Sha, I believe say everything go still dey alright, maybe all this one dey happen because say we dey for Christmas and new year celebration and season, I believe say as soon as Christmas celebration and new year is over, system go reset back to normal again.