Omo my people how una dey na, I know say e dey kind of late, but una see wetin federal government don do, dem get mind ban crypto walka for inside naija, knowing fully well say most people for the country na from crypto them dey get their daily bread as per say naija no work again, but anyhow them do them no fit stop crypto sha, we go adapt den move on, boys no go fit dey withdraw from binance to bank but we fit use P2P trade our crypto on Binance to get naira sha, just that binance own been dey much easier,but anyhow we go survive, I just say make I share the news here make we discuss about am.
So how una see dis matter?