1
Nigerian Languages / Re: EFCC Bans US Dollar Transactions In Nigeria.
« on: Today at 10:01:09 PM »Naija Neva ripe to do away with dollar. As long as corruption still exists for the country naija, no worry dollar Na baba for the looters to use do their things coded. All these public ranting wey dem dey do Na just to fulfill all form of righteousness make the people feel say dem dey try to stabilise the naira value but my brother we all know say Na medicine after death and dem no go fit do anything against their own belle.I do not believe that would hold any water.As you talk am na so the matter be. Di matter e no get hear. I think say dem even serious about the banning of the dollar in the country I come dey see say even in their news room when dem dey call big amount of money na dollar I dey hear and na there I come realize say this fight with dollar na to only deceive the people in the country and not to implement am make di thing work. Even di Economic policies na to against the citizens and not to make things good form them.
The only thing we go pray Na be say make every one individual for the country just find way dey survive because Na only person wey dey alive dey live dey work to get money and to live to tell the story as things be. As it stands now the government no dey help matters at all.