Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: nelson4lov on October 17, 2020, 05:52:47 PM

Title: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: nelson4lov on October 17, 2020, 05:52:47 PM
Omo no be news again oh, youths for Nigeria Don Para, come mount this time say if government no end Sars (#EndSars) for Nigeria dem no go back down oh, so tey them start to crowd fund oh, first time na flutterwave been dey help dem drop the money, but as government notice immediately na dem rush block flutterwave crowd funding account oh, na there Nigeria youths Para come start to donate in bitcoins instead of cash oh, like dis even Jack the owner of Twitter talk say make people "donate bitcoin" to Nigeria, for one of him tweet on Twitter, last night sef I check 24hrs trade volume for binance,omo na NGN/BUSD volume na be the highest, so my people how una see am na, like dis enough people Don come know about bitcoin, this thing fit lead to mass adoption for Nigeria?
Title: Re: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: tinakoya on October 20, 2020, 07:31:33 PM
What me i know be say, de way cryptocurrency dey decentralized even naija government no fit stop this thing. See how much volume NGN dey binance. Together we fit do plenty good tin. Dem must know say ebi d youth era we dey na
Title: Re: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: nelson4lov on October 22, 2020, 05:48:20 PM
What me i know be say, de way cryptocurrency dey decentralized even naija government no fit stop this thing. See how much volume NGN dey binance. Together we fit do plenty good tin. Dem must know say ebi d youth era we dey na
No be lie, I see volume for binance I shock I swear I no know say Nigerians plenty there oh, Mehn, omo the last time I hear the amount way them raise shock me, over 69 million naira, the other day them raise 25million in 24hours, youths dey vex now oh, like this that protest Don get out of hand, e dey bloody now.
Title: Re: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: tinakoya on October 22, 2020, 11:16:52 PM
But I hear say na prisoners and thugs dey damage everywhere to discredit the peaceful protesters oooooo
Title: Re: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: nelson4lov on October 24, 2020, 05:46:10 PM
But I hear say na prisoners and thugs dey damage everywhere to discredit the peaceful protesters oooooo
Like this Nigeria Don turn to smtin else, those thugs na government send them (I get the videos them) na government strategy to talk say na the peaceful protesters cause am from there them fit get wetin to use hold the youths, the one way pain me pass na that one way Lagos state governor go lie for live TV, plus buhari own, I kukuma tire for the country.
Title: Re: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: tinakoya on October 25, 2020, 03:20:27 PM
Youth for regroup and re-strategize the whole thing. Naija need to be reborn and we need new party for that. If dem start the process now e go fit dey possible by 2023
Title: Re: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: festilolo on October 25, 2020, 03:26:00 PM
As things be now we need to be strategic otherwise all these old men for Naija go use us play ball seriously. Our politicians don use hunger strategy to hold the masses down for too long. We need to dey participate for politics now because na from inside we fit fight this fight, we need to start now in order to galvanize wella. We go need to preach to the youths to shun greed, make we no bring in religion and tribe as well because na wetin fit divide us sharp sharp
Title: Re: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: tinakoya on October 25, 2020, 03:29:05 PM
E go better make all youth come together as one, dem for fashi tribalism and tins and focus on how to take the country from those old criminals
Title: Re: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: nelson4lov on October 27, 2020, 06:20:56 PM
E go better make all youth come together as one, dem for fashi tribalism and tins and focus on how to take the country from those old criminals
These old people no get any good thing to offer us again, all wetin dem know how to do na to just they thief our money, dey store for their children, if young person rule us e go better pass this old hags, make 2023 do reach, we no go take this nonsense again.
Title: Re: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: tinakoya on October 28, 2020, 03:19:45 PM
E go be young person wey get experience, dem fit start being in house of rep then grow from there so when next election come and dem see how we dey arrange ourselves, dem go no say we no dey joke.
Title: Re: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: nelson4lov on November 04, 2020, 08:15:39 AM
E go be young person wey get experience, dem fit start being in house of rep then grow from there so when next election come and dem see how we dey arrange ourselves, dem go no say we no dey joke.

Na so. With the way youths protests on the street about the #EndSARS matter and even trend am steady on Twitter, e show those politicians say na only a matter of time before youths take over the system. The President fit don stop street protests but e no go fit stop wetin go happen in the near future as youths don wake up and ready to take up the driver seat for the first time.
Title: Re: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: Mexite on November 04, 2020, 07:47:28 PM
 The #EndSARS protest don show say we fit come together as one change naija but we gas be careful who go lead among d pack cos some people jus dey disguise.

Proper selection and screening na im we go do, make ethnicity or religious affiliation cos na wetin dem old politicians dey use divide us b dat.

D country still get future.
Title: Re: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: yemight62 on December 01, 2020, 07:37:05 PM
Abeg any update concerning the donated coin? As #endsars don finish we no hear anything again.
Title: Re: Nigeria dey donate bitcoin, na mass adoption be this?
Post by: poles1469 on August 12, 2021, 01:48:07 PM
i thought she gets from dbx token