Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: nelson4lov on February 07, 2021, 05:36:30 PM

Title: Fed Govt. Don ban crypto for naija oh
Post by: nelson4lov on February 07, 2021, 05:36:30 PM
Omo my people how una dey na, I know say e dey kind of late, but una see wetin federal government don do, dem get mind ban crypto walka for inside naija, knowing fully well say most people for the country na from crypto them dey get their daily bread as per say naija no work again, but anyhow them do them no fit stop crypto sha, we go adapt den move on, boys no go fit dey withdraw from  binance to bank but we fit use P2P trade our crypto on Binance to get naira sha, just that binance own been dey much easier,but anyhow we go survive, I just say make I share the news here make we discuss about am.
So how una see dis matter?
Title: Re: Fed Govt. don crypto for naija oh
Post by: Imma Amaechi on February 10, 2021, 02:45:25 PM
We are bigger than the restrictions...
Title: Re: Fed Govt. don crypto for naija oh
Post by: Mexite on February 10, 2021, 11:43:58 PM
I tire for this our government wey no dey open to new innovations and technology. Wetin I no be say dem no fit ban crypto unless dem go ban internet. Shebi na only crypto platform to bank transactions na im dem ban, dem no sabi say p2p dey there wey dem no fit trace.
Title: Re: Fed Govt. don crypto for naija oh
Post by: Delgboke on February 16, 2021, 06:34:26 AM
That's the worst thing that government of Nigeria has Don to our people for thinking of banning crypto for our country that shows that government don't have better plan for our country at all, but sha the house of Senate is pushing hard to see say crypto is been adopted in our crypto because even their own children are into crypto business.
Title: Re: Fed Govt. don crypto for naija oh
Post by: Stuart on February 20, 2021, 03:34:27 PM
I tire for this our government wey no dey open to new innovations and technology. Wetin I no be say dem no fit ban crypto unless dem go ban internet. Shebi na only crypto platform to bank transactions na im dem ban, dem no sabi say p2p dey there wey dem no fit trace.

Nor mind them, them think say to ban crypto for naija mean say them done ban am finish for the people way de trade am inside the country. Na madeness de worry them. MBA way been they help people, na so them ban am, now, them carry their face come crypto. E don purge them because the banks them no oh fit make transactions to crypto from bank again, except, them oh violate the law way their fathers don put for ground.
Title: Re: Fed Govt. Don ban crypto for naija oh
Post by: Sammy9ce on March 01, 2021, 09:23:43 PM
Government go just dey mumu, them rush ban crypto because say them notice as youth they progress and them no want the youths progress. But anyhow we go still use binance peer to peer.