I have been meaning to do this for a while now but each time I get distracted and laggard. I want us to have an avenue of sharing some of our indigenous proverbs while still learning the crypto stuff.
— E don tey wey I be dey plan to do this thing here but each time too much distractions dey carry my mind comot from am. I go like make our area people share some of our local proverbs here with their explanations. I go put the proverbs in bold.
Share a proverb, and then put up its meaning. It will be best if the proverb is written in pidgin English.
Make I kick start am with some Warri flavour. Area!
Nor be today wey yansh don dey back.
Meaning: We are used to such a situation.
Dem nor dey tell blind man sey salt nor dey soup, you fit tell am sey oil nor dey.
Meaning: Obvious things don't need explanations