Union don drop another article, and trust me when I tell you say you go really enjoy the new one wey dem drop.
The whole article nah about one new bill wey dem be wan sign for U.S, this bill so go make everybody wey Dey in possession of $10,000 above declare their possessions, meaning if your monetary value nor reach 10k dolls then you fit pass border or stay for U.S without declaring anything but as soon as you don worth reach that amount you go need to go declare am.
But the thing wey make am worse be say, nor be only fiat the thing go affect - the bill nah for anything wey dem fit identify as “
monetary instrument” Meaning even the crypto wey we Dey use take Dey enjoy our small privacy go still Dey affect - meaning if you get up to $10,000 worth of bitcoin or other monetary instrument you go need to still declare am unless if them catch you by themselves dem go charge you with money laundering and you fit do some years for
Kirikiri just because of money wey you get - the source nor really concern them as long as you keep am hidden you don commit crime be that.
See the link here if you wan get the full gist:
Bitcoin: Attempts to control