Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: Thyplaymaker on December 23, 2023, 12:38:52 AM

Title: How you guys preparing for the Christmas.
Post by: Thyplaymaker on December 23, 2023, 12:38:52 AM
Few days left before Christmas, we know shey bitcoin go experience small dip mostly for this celebration season  because some pipo go convert some of their token to fiat tey flex for this this Christmas wellsha make we still try keep for the next year bullish run oh,make we nor miss out for this great opportunity.
As we continue to hold we go surely profit from am. So wish y'all the best and merry Christmas in advance!! ;D
Title: Re: How you guys preparing for the Christmas.
Post by: Hatchy on December 23, 2023, 06:37:57 AM
How Dem wan Tay covert dem coin boss? Abi u no dey see d way transaction fee take dey high. Time like dis, na baba Dem wey get better investment for Bitcoin na go benefits as even the transaction fee no go even shake Dem. D matter na because of all dis ordinals wey just dey block chain and d whole matter I no know watin our developers dey do about am. Miners just dey get am clear for dis period.  D best thing for now na to just rest for small small transaction wey no get head, because dat wan go only dey make u loss money.
Title: Re: How you guys preparing for the Christmas.
Post by: Youngkhngdiddy on December 25, 2023, 05:31:09 PM
Christmas don finally reach, how e be for our sides? No cap buh the weeks before Christmas been jus dey look one kain way. The Christmas was not christmasing at all. Sadly, e sure me die say 98% of people no really go back their base. The economy don make this year Christmas dey less fun. For this side wey I dey, to shoot knockout sef na heavy duty. When you reason the cost of the knockout, then try compare am to other options of needs you go fit meet with that amount, na you go stay change mind on shooting knockouts.
  As cruise no dey everly fail for the country na, shey days ago we been follow up the trend based on Bethlehem wey cancel Christmas because of their wars and all, truth be say since December 1st, Nigeria been in no get the Christmas atmosphere. Even though we don try in our little space just decide to make today make small sense by cooking some kind meals, the day deep down inside our heart be like a usual Monday. We still get more celebrations to run through before this tenure finish. God no go gree make condition worse pass as e dey now because e for really dey bad. All thesame, all Christmas blessings and good tidings go reach us one by one on God.
Title: Re: How you guys preparing for the Christmas.
Post by: Thyplaymaker on December 25, 2023, 07:16:45 PM

Lol yeah i understand the matter. E nor really easy Ohh but men still got to turn up that food part nice. Nah rich kids dey shoot knockout now, but it still dey light up things sha, well I'm just waiting to Matt the year of green which is next year, so we just got to thank God for bringing us this far things hard but we still dey survive that one don already reach for pesin to thank God oh. So we you'll the best and a merry Xmas
Title: Re: How you guys preparing for the Christmas.
Post by: Tribalchief on December 25, 2023, 11:15:37 PM
Well, I guess this year's Christmas happens to be a regular day, with just less than six(6) days for the year to end. All that matters now is what going to happen next year. I was quit surprised with the increase in T-fee in my area. This country no just funny again my piple.
Title: Re: How you guys preparing for the Christmas.
Post by: Seniorman on December 27, 2023, 02:10:02 PM
We don dey inside the Christmass and I dey rest assured say e dey go very smoothly. The market surprise me this time I been dey expect say e go experience one kind correction for this season but the way the price just dey with little down market just dey surprise me. Be like most people don understand say base on this festive season no be enough reason to begin sell out their investment.
Title: Re: How you guys preparing for the Christmas.
Post by: Thyplaymaker on December 28, 2023, 10:18:44 AM
We don dey inside the Christmass and I dey rest assured say e dey go very smoothly. The market surprise me this time I been dey expect say e go experience one kind correction for this season but the way the price just dey with little down market just dey surprise me. Be like most people don understand say base on this festive season no be enough reason to begin sell out their investment.
Nah me wetting I b dey expect Shey men go sell for their investment tey flex for the season, but market nor do any corrections like that so men still dey Ohh I guess no body wan miss out for the next bull run during d halving Omo nah to hodl oh