no mind that guy. he go dey talk anyhow. i no blame binance for removing his bitcoin cash version. na so sweet mouth go dey put some of them for trouble. if not for the help of some exchange in the usa. his version of coins will be faced out from top 100 cryptocurrencies. he is just a lucky dude.
I beg to differ my guy, since I do dey hear about this craig Wright guy, this na the only thing wey him don talk wey me I agree say he dey correct.
Make una check am na, if person say true true, he dey legit, wetin won come make that person dey hide himself??, as per my own experience, na only scammers and fraudsters na im be the set of people wey dey always try to stay anonymous, or person wey don commit for one place and no want make people know where him dey, though sometimes, some rich men dey won stay anonymous too ooo, but no be to the extent wey all this criminals dey take am