Oya, make una chuck mouth for this matter...
How many total wey you mine? I look at the project and some persons still dey struggle to pass the KYC and saw alots of complain too.
Ahh, boss, to be honest, just like I be don talk for that our group, be no too mine plenty because right from the beginning, I no take them serious, I only managed to mine close to 2000 Avive tokens, so based on the 15 percent wey they Don release give me, I don sell am sha, but the money no even reach anything because the price is just around $0.122 or a little above.
Na people way take the mining serious na them get luck, like for my area here right now, one guy just dey pop bottle anyhow anyhow, the guy mine over 200,000 of the token, dey release 15% give am which is 30,000 tokens, the dude Don sell am cash out around 6.3 million naira, and this na him first ever crypto currency, he no dey into crypto before, na him place I dey like this to follow him celebrate.