One of my friend way I tell about crypto currencies, em like everything I tell am, em come say em wan start with trading. Now I ask am like how much em get to use take start em say na $20, I smile, but on the other hand, na money. So, make em continue or make em increase the capital?
How una see the matter?
Yes na.
Buh the thing be say,one thing youa suppose know as you be investor be say trading be like casino.The higher you stake,the higher return wey you go get and the lower you stake,the Lower retur you gazz still get.
But anyhow sha,i myself fully understamd why e talk say e wan use 20 dollars.Reason be say,person wey never profit from trading no go wan put all e assets or put alot of capital untop trading because e no know wetin go still sup,whether e go benefit or whether e fit loose.But as time goes on,with the right investment decision ,e go dey stake higher gradually.E dey common with newbies.