Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum
Local => Nigerian Languages => Topic started by: Stuart on November 23, 2019, 02:12:38 PM
-
As NGN done enter binance, anybody join the campaign, abi em be nor get campaign / project. As a stable coin way I sure say em go be, em go affect positively to the growth/development of Nigeria currency or.....?
-
bros, i like the fact that the token na our own nigerian currency but it pain me say the exchange rate too high. for me to trade NGN with USD come be like say not way. As binance take wicked, they allowed us to trade NGN with BUSD. IT IS VERY BAD for me. they should allow us trade NGN with USD.
-
Bank transaction fee dey huge to do transaction for Binance why.
-
Ngn no be coin nah, I think Dat one nah stable like usdt for naija to be able to buy and sell on binance, nothing special there for me sha, but I like how binance come give us opportunity for direct payment and withdraw, luno don show us pepper.
-
Binance really help us well well, now you no need to dey hawk Ethereum, USDT or Bitcoin like who dey sell crayfish. The thing wey sweet my belle pass na the direct naira withdrawal to our naija bank account, the thing no dey waste time to show for account at all.
-
NGN no be coin ooooo but a fiat currency where Nigerians can sell off their assets into NGN and withdraw into their local bank. This is one good feature Binance put in place to promote the blockchain technology viz-a-viz cryptocurrency in Nigeria as a whole.
-
bros, i like the fact that the token na our own nigerian currency but it pain me say the exchange rate too high. for me to trade NGN with USD come be like say not way. As binance take wicked, they allowed us to trade NGN with BUSD. IT IS VERY BAD for me. they should allow us trade NGN with USD.
Oboy, the way I see that Naira to BUSD thing, I dey feel like na just way for binance to use promote that their BUSD coin/crypto fiat, nothing else them no even allow boys trade with usd directly, na strategy for people to dey use am sha, na for their own good :o.
-
this post don old sha but na better and quality News. the Koko be say the volume for trades in BUSD/ETH, BTC/USDT on binance don reach like 1 billions Naira. Naija dey move this crypto market to be honest.

Na so. The volumes I dey see these days dey insane. More Nigerians dey use crypto and appreciate NGN pairs on Binance. Recently sef, Binance add NGN/TRX pair as most Nigerians dey link TRON so e suppose bring more volume. My only problem with NGN payments na the withdrawal. N300 per withdrawal but e still dey fair compared to using btc withdrawal fee wey dey around 4-7 usd or N1500 - N2500.
-
CZ don sabi say naija countrymen dey trade crypto wella na why e list NGN for em exchange so e go dey easy for traders to buy and sell.
My own worry be say govt don put limit for d amount wey person fit spend in dollars on naija account, if not beta deal dey plenti to do
-
Whala Be like bicycle for who get naira as asset. The thing don even turn #500/$1 i no know where this country dey go o
-
Whala Be like bicycle for who get naira as asset. The thing don even turn #500/$1 i no know where this country dey go o
Lmao, omo this country tire me I no know where this buhari administration dey go sef, omo I don tire, everyday the cost of living inside naija dey increase, although as the naira to dollar rate dey high e dey favour us way dey normally change our crypto to naira, so make e dey increase dey go since buhari no wan do better thing.
-
I no sure say that NGN na coin. That NGN just they like the way USDT dey, the thing they stable and dem drop m der so that we fit use our country value trade. With that NGN you fit just buy deposit leave am e go dey same value with our bank own.
-
i thought she gets from dbx token