Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: Justinmoon on June 29, 2023, 08:44:04 PM

Title: Make una try dey active
Post by: Justinmoon on June 29, 2023, 08:44:04 PM
I have been on this forum for quite a while now, but notice say this our board too dey inactive.
Abahhh, since February no body don create any topic make we discuss. why is this so. Please my country people make una fall out ooo this forum na better one and e go clear if we manage am we'll just like other local board take dey.
Please let's try our best to visit here once in a while, as I will be managing it from now on. (Note, I'm not a moderator or something, I'm just here to bring altcointalk back to live)
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Aksisa on December 07, 2023, 08:22:14 AM
Dis na my first post for this forum and as I join I say make I come align with my local community. Upon coming here, I see say d board no too dey very active and many posts don dey wey no activity don dey. I get knowledge about altcoin but I say make I come join here to share ideas with more people wey get interest for cryptocurrency like me so dat we go brainstorm together. Wuna all welldone.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Seniorman on December 07, 2023, 02:01:42 PM
Dis na my first post for this forum and as I join I say make I come align with my local community. Upon coming here, I see say d board no too dey very active and many posts don dey wey no activity don dey. I get knowledge about altcoin but I say make I come join here to share ideas with more people wey get interest for cryptocurrency like me so dat we go brainstorm together. Wuna all welldone.
I just dey join the forum now, I come dey navigate through the forum come understand say here get local board wey our Nigeria people dey stay yarn matters about cryptocurrencies. I come dey observe say e no too dey flow for here, everywhere just dey dormant come be like say nothing dey happen for here I just dey imagine cos I believe say anywhere Nigerians dey, dey always bubble cos we smart wella.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Cryptsafe on December 07, 2023, 06:39:45 PM
Country men. No worry we don show for the alma matter here. Very soon we go dey shake the ama with our swags. You know say Naija no dey take last for their mata so no expect us to settle for less.

Very soon more Naija big names go join us for this matter as e dey go so.  Una don try for the move una don make for here. I don see as Naija board don get child boards wey go make things very easy to do here. Una weldone o.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Thyplaymaker on December 07, 2023, 10:34:12 PM
Ma people I greet Ohhh
I also just join this forum and found out Shey this our board nor active,
But well sha I will b trying ma best to be always active to keep this board
Active too as I can
Naija board nor fit just calm like this nah
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Roseline492 on December 08, 2023, 12:33:48 PM
The reason why we been no they active here na because say everybody mind and attention been they focus to our other forum and things way that side been get, been nava they here but however with the new development way done come out now, done give us the reason why we go focus on this forum and put our energy to make it lively.

I no go lie I like the way this place they, the way everything they and the way the moderators they very friendly however na good sign say we go enjoy the place.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Mate2237 on December 08, 2023, 08:56:16 PM
Abeg make una show me road, I don lost be this. Where is service board? I don find am tire I never am where I go go see am or abeg make una drop di link.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: rachael9385 on December 09, 2023, 09:39:17 AM
Una good morning, I just dey BTT and my guys dem give me update about this ALT, so me I no really know were I go start from. But I really dey happy say my fellow Nigerians self dey here.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Mia Chloe on December 10, 2023, 09:01:28 PM
My fellow 9ja pipo I greet oo dis one na my first post for we local board I say make I still check out dis side based on say na btt I Sabi b4. I still nova understand here well well but wit time sha I go sab
Seasons greetings
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Igebotz on December 10, 2023, 11:48:16 PM
Abeg make una show me road, I don lost be this. Where is service board? I don find am tire I never am where I go go see am or abeg make una drop di link.

https://www.altcoinstalks.com/index.php?board=2.0
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Dr.Bitcoin_Strange on December 11, 2023, 02:06:16 AM
Greetings my people...

Gradually, we will become active on this forum and new and relevant topics will begin to fly around  8).

What good use have you actually put to the money you won from gambling? (https://www.altcoinstalks.com/index.php?topic=313005.msg1453796#msg1453796)

That's a new topic on the gambling section, should any one mind 😏 sharing some experiences.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Obari on December 11, 2023, 05:42:21 AM
Country men. No worry we don show for the alma matter here. Very soon we go dey shake the ama with our swags. You know say Naija no dey take last for their mata so no expect us to settle for less.

Very soon more Naija big names go join us for this matter as e dey go so.  Una don try for the move una don make for here. I don see as Naija board don get child boards wey go make things very easy to do here. Una weldone o.
Even my oga don reach here and he even wear signature ❤️ congrats big name and I believe say togther we go also gain ground for here but truth be told that, this other forum Dey more complicated than we’re we Dey come from but normally, nothing Dey just happen because it must start from somewhere and with all this stuffs been said, @op try make you stay active as you don take the responsibility upon yourself, I believe say no be easy task but brotherman I assure you say e go definitely pay off when the time come.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Tribalchief on December 15, 2023, 09:36:07 PM
I think, one important thing be say: make we stop to dey counter people opinion, thereby making dem look foolish. Person fit get post, but wen e consider say everybody go wan dey counter e own opinion, e go just relax.

Na why I dey always like to appreciate piple post, B4 i politely correct were dey 4 wrong.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Yamzakid on December 15, 2023, 09:48:55 PM
Dis na my first post for this forum and as I join I say make I come align with my local community. Upon coming here, I see say d board no too dey very active and many posts don dey wey no activity don dey. I get knowledge about altcoin but I say make I come join here to share ideas with more people wey get interest for cryptocurrency like me so dat we go brainstorm together. Wuna all welldone.

E shock me too o as I see Naija board dey dry like this, we all know sey Naija no dey carry last why we wan come carry last for here na? When I joined this forum, I con go read the forum rules and the next place I start to look for na our Naija board because I know things dey always happen for where Naija people dey.
Sha I know sey wan day we go top all the other boards, but if we no start am now when we go con start?
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Gormicsta on December 16, 2023, 12:20:59 AM
I have been on this forum for quite a while now, but notice say this our board too dey inactive.
Abahhh, since February no body don create any topic make we discuss. why is this so. Please my country people make una fall out ooo this forum na better one and e go clear if we manage am we'll just like other local board take dey.
Please let's try our best to visit here once in a while, as I will be managing it from now on. (Note, I'm not a moderator or something, I'm just here to bring altcointalk back to live)

Na true talk you talk, na just time we need and better cooperation for this our local board. But make we wey want make the board dey active dey pit hand together dey push this our local board small small until other people see wetin dey happen here, walahi them go join us.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Cryptsafe on December 16, 2023, 02:10:54 PM
Country men. No worry we don show for the alma matter here. Very soon we go dey shake the ama with our swags. You know say Naija no dey take last for their mata so no expect us to settle for less.

Very soon more Naija big names go join us for this matter as e dey go so.  Una don try for the move una don make for here. I don see as Naija board don get child boards wey go make things very easy to do here. Una weldone o.
Even my oga don reach here and he even wear signature ❤️ congrats big name and I believe say togther we go also gain ground for here but truth be told that, this other forum Dey more complicated than we’re we Dey come from but normally, nothing Dey just happen because it must start from somewhere and with all this stuffs been said, @op try make you stay active as you don take the responsibility upon yourself, I believe say no be easy task but brotherman I assure you say e go definitely pay off when the time come.

Chief I greet you too. We dey here together o. Make we run the town together like nothing happen. E dey sweet me say country people dey quick to show up here. One thing I go like make we for do be say make we wey don already show up here try our best to make sure say own very own board dey much active here so that others wey come go see am den dey encouraged to dey active because Na we wey don already land here go make way for others  to come see for themselves how things dey happen here. Na so dem too go tell others

As for the platform, I believe say the platform go dey easy to navigate as time goes on since e be say we never dey used to am and also, more development and update go dey take place as the traffic dey increase.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Coinmama7824 on December 16, 2023, 05:20:59 PM
I have been on this forum for quite a while now, but notice say this our board too dey inactive.
Abahhh, since February no body don create any topic make we discuss. why is this so. Please my country people make una fall out ooo this forum na better one and e go clear if we manage am we'll just like other local board take dey.
Please let's try our best to visit here once in a while, as I will be managing it from now on. (Note, I'm not a moderator or something, I'm just here to bring altcointalk back to live)

Na true talk you talk, na just time we need and better cooperation for this our local board. But make we wey want make the board dey active dey pit hand together dey push this our local board small small until other people see wetin dey happen here, walahi them go join us.

Yes and make we also dey tell people about this amazing forum, I believe say we get people for BTT wey never too sabi about this place, we fit also tell them about am make we bring this place to life too.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Thyplaymaker on December 18, 2023, 11:41:13 PM

Yeah most pipo neva too hear about this forum. Aslong we dey active and we dey responds well jejely this place go lively anyhow. So make we still dey give am our best bcus nah this local board e dey sweet me pass to dey post
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Fivestar4everMVP on December 19, 2023, 07:06:08 AM
Country men. No worry we don show for the alma matter here. Very soon we go dey shake the ama with our swags. You know say Naija no dey take last for their mata so no expect us to settle for less.

Very soon more Naija big names go join us for this matter as e dey go so.  Una don try for the move una don make for here. I don see as Naija board don get child boards wey go make things very easy to do here. Una weldone o.
Even my oga don reach here and he even wear signature ❤️ congrats big name and I believe say togther we go also gain ground for here but truth be told that, this other forum Dey more complicated than we’re we Dey come from but normally, nothing Dey just happen because it must start from somewhere and with all this stuffs been said, @op try make you stay active as you don take the responsibility upon yourself, I believe say no be easy task but brotherman I assure you say e go definitely pay off when the time come.

Chief I greet you too. We dey here together o. Make we run the town together like nothing happen. E dey sweet me say country people dey quick to show up here. One thing I go like make we for do be say make we wey don already show up here try our best to make sure say own very own board dey much active here so that others wey come go see am den dey encouraged to dey active because Na we wey don already land here go make way for others  to come see for themselves how things dey happen here. Na so dem too go tell others

As for the platform, I believe say the platform go dey easy to navigate as time goes on since e be say we never dey used to am and also, more development and update go dey take place as the traffic dey increase.
You are right dear brother, I completely agree with, for me Sha, I don tey wey I don join this forum, only thing be say, as nothing much been dey happen for here, e make me no too dey active like that, but with the current development on the forum, I believe say things go dey different from now on and going forward.

So, for me, wetin I fit talk or advice now be say, as we don dey here, make we try use this medium to share very important information wey fit benefit us all, not just to dey discuss things wey no make any sense, or dey relevant to our being in crypto, they dey talk say information na power, so, once again, make we all try to use this medium to share only things wey go benefit us all.

Meanwhile, good luck to every one of us and happy holidays and seasons greetings..
Title: Re: Make una try dey active
Post by: philostickz on December 21, 2023, 12:03:17 AM
Omo when I see this post I been think say na recent post when I check date I shock since June true true we no really dy active I been wan comment on a post I see warning when I check date since 2019 am here to stay and I go like make all of us join hands to make Altcoins active Thanks.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Ehyowiz on December 21, 2023, 09:24:42 PM
Omo when I see this post I been think say na recent post when I check date I shock since June true true we no really dy active I been wan comment on a post I see warning when I check date since 2019 am here to stay and I go like make all of us join hands to make Altcoins active Thanks.
   Yeah no be lie, and be like say people never really sabi navigate the forum yet. And I believe say with the kind of engagement way we go put in am, the owners go wan do some new development for the forum. And I notice say the users of this forum don follow increase, with the kind of engagement way them day get, they go need make the forum more user friendly. Newbie like me now way still day find their way around the forum. But I know say if you zero your mind to run something then you go learn am.
     
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Cryptomultiplier on December 22, 2023, 05:18:32 PM
Na the interest go determine how person go take dey active, because new teleported members have to first understand how this interface be, as I don notice say e dey very different from Bitcointalk forum interface.
Also, I know say na because of the ban on mixers make this side get acknowledgement and new members and for those wey don dey used to or at least don enjoy signature campaigns money small, e dey hard to even start a fresh here and be out of cash in the real sense of things.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Gormicsta on February 15, 2024, 06:11:29 AM
Better advice be this for our own good, if we dey dey active, we go dey get updates and e go dey very helpful for us.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Samlucky O on February 15, 2024, 03:24:16 PM
I have been on this forum for quite a while now, but notice say this our board too dey inactive.
Abahhh, since February no body don create any topic make we discuss. why is this so. Please my country people make una fall out ooo this forum na better one and e go clear if we manage am we'll just like other local board take dey.
Please let's try our best to visit here once in a while, as I will be managing it from now on. (Note, I'm not a moderator or something, I'm just here to bring altcointalk back to live)
Sincerely speaking bro. This altcointalk just dey somehow. Bitcointalk dey more clear than this place and many people no even know about here. And the mode of doing things here just dey one kind. But any way gradually gradually people go show. E go really take time for more people to know about the altcointalk.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: SmartGold01 on February 17, 2024, 12:19:53 AM
Make I tell you truth e no easy oo because as pesin don dey used to other side of the forum e dey hard pesin to focus here because the entire environment dey different with the ones wey our eyes don capture since, so even though things self pure here na dis karma of a tin e no too good because dem no suppose put were person go give you N-karma and you go dey on minus sometimes e dey weak pesin to put pressure because e get how you go carry work like this person go just give you - your eyes go clear wey be say e hard to give pesin +1 self. Again make admin increase am then remove the (-) minus.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Gormicsta on February 17, 2024, 06:26:21 AM
Sincerely speaking bro. This altcointalk just dey somehow. Bitcointalk dey more clear than this place and many people no even know about here. And the mode of doing things here just dey one kind. But any way gradually gradually people go show. E go really take time for more people to know about the altcointalk.
[/quote]

Sense dey inside this your talk, for me I no too really understand how this altcoins dey go, dey be like person dey go front, then later dem dey draw you back and even for campaign side, I no really understand too, make una no vex o but for me e dey be like them dey accept people wey them sabi but as you talk, small small e go dey like Bitcointalk
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Gideon99 on February 23, 2024, 11:32:56 PM
I have been on this forum for quite a while now, but notice say this our board too dey inactive.
Abahhh, since February no body don create any topic make we discuss. why is this so. Please my country people make una fall out ooo this forum na better one and e go clear if we manage am we'll just like other local board take dey.
Please let's try our best to visit here once in a while, as I will be managing it from now on. (Note, I'm not a moderator or something, I'm just here to bring altcointalk back to live)

That's no be only me don notice am too Omo this Nigeria board too dey quite make una try dey bring up trends there slots of happenings in the country let's discuss about them here, talk your mind your post new topic make the forum come back to life joor .
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Maxwell99 on February 27, 2024, 07:15:07 AM
I have been on this forum for quite a while now, but notice say this our board too dey inactive.
Abahhh, since February no body don create any topic make we discuss. why is this so. Please my country people make una fall out ooo this forum na better one and e go clear if we manage am we'll just like other local board take dey.
Please let's try our best to visit here once in a while, as I will be managing it from now on. (Note, I'm not a moderator or something, I'm just here to bring altcointalk back to live)
You are right because like this all our people dey post for other forum them forget the Nigeria board everywhere just dey make we try create thread and interact with each other here, keep the forum alive again since last month the forum just dey no thread topic e no good
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Cantsay on February 27, 2024, 09:43:58 PM
~~~
You are right because like this all our people dey post for other forum them forget the Nigeria board everywhere just dey make we try create thread and interact with each other here, keep the forum alive again since last month the forum just dey no thread topic e no good

The type of topics still contribute to why people nor wan gree Dey contribute for discussion here.

Okay, just go Nigeria board look the first 15 threads if you come forum and you see those kind threads you go like join that kind discussion? Aside from that, most of them nor be waiting Dey ignite debate and discussion, imagine post wey be say nah only the definition of the term he get, how we wan take contribute for that kind conversation?

If more constructive discussion come we go join, the few ones wey I feel say dem nor too bad nai I talk out but for the rest I go later report them to mod make he lock dem cause I nor see any need for them.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Agbe on February 27, 2024, 10:51:40 PM
You can also create threads for us to discuss. We dey thread but as no good topics to discuss nai make many us never visit here like that dat and another thing be say as many of us e no dey campaign foe now e come make them e dey inactive and we believe say once new campaign comes and many of our guys enter work then di local board go dey active. But don't worry we go do something we go make some of the inactive members to come and be active again. Everything na creative. As me e don dey like two weeks wey I never visit here.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: SmartGold01 on February 27, 2024, 10:52:23 PM
The type of topics still contribute to why people nor wan gree Dey contribute for discussion here.

Okay, just go Nigeria board look the first 15 threads if you come forum and you see those kind threads you go like join that kind discussion? Aside from that, most of them nor be waiting Dey ignite debate and discussion, imagine post wey be say nah only the definition of the term he get, how we wan take contribute for that kind conversation?

If more constructive discussion come we go join, the few ones wey I feel say dem nor too bad nai I talk out but for the rest I go later report them to mod make he lock dem cause I nor see any need for them.

Omo e get some topic wey no dey really easy to involved in discussion because of nothing meaningful those topic person especially topic like political talks e don really tire me because every time we dy always bring we country mata come online e dey make us feels like we no get privacy even though say we go spread am online but make e no be here wey we dy take manage because if we give a bad misrepresentation of our country na so pipo wey dey hia go take see us as well. Even though we dey online make e be say na for quality post we go always put them.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Gideon99 on March 01, 2024, 12:44:32 PM
I have been on this forum for quite a while now, but notice say this our board too dey inactive.
Abahhh, since February no body don create any topic make we discuss. why is this so. Please my country people make una fall out ooo this forum na better one and e go clear if we manage am we'll just like other local board take dey.
Please let's try our best to visit here once in a while, as I will be managing it from now on. (Note, I'm not a moderator or something, I'm just here to bring altcointalk back to live)
You are right inactive but mostly the active ones are just spammers posting low quality shit every Time, please if you don't have relevant thing or thread oles don't post just reply and contribute to the forum that will help the discussion here rather than post shit posting just for post count and it's very wrong here, we don't do that here so try your possible best to read well careful before replying to any post inorder to keep your account safe
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Thyplaymaker on March 01, 2024, 04:29:38 PM
The type of topics still contribute to why people nor wan gree Dey contribute for discussion here.

Okay, just go Nigeria board look the first 15 threads if you come forum and you see those kind threads you go like join that kind discussion? Aside from that, most of them nor be waiting Dey ignite debate and discussion, imagine post wey be say nah only the definition of the term he get, how we wan take contribute for that kind conversation?

If more constructive discussion come we go join, the few ones wey I feel say dem nor too bad nai I talk out but for the rest I go later report them to mod make he lock dem cause I nor see any need for them.

Omo e get some topic wey no dey really easy to involved in discussion because of nothing meaningful those topic person especially topic like political talks e don really tire me because every time we dy always bring we country mata come online e dey make us feels like we no get privacy even though say we go spread am online but make e no be here wey we dy take manage because if we give a bad misrepresentation of our country na so pipo wey dey hia go take see us as well. Even though we dey online make e be say na for quality post we go always put them.
lol exactly e get some topic u go just see you go tell your self Omo nah only learn I go fit learn from this post I nor think say I go fit interact. And most people can relate to this. So just get some post wey be say the only thing u fit do nah to learn from it.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Cantsay on March 01, 2024, 07:16:50 PM
lol exactly e get some topic u go just see you go tell your self Omo nah only learn I go fit learn from this post I nor think say I go fit interact. And most people can relate to this. So just get some post wey be say the only thing u fit do nah to learn from it.

The two users wey been filling our local board withnl such type of posts have been given some levels of warnings - and for since when they got the punishment for spamming they have refused to logged into the forum again. This should stand as a warning to others unlike Bitcointalk local board that doesn’t have moderator this one has a moderator that’s actively trying to keep the board clean.
Title: Re: Make una try dey active
Post by: Thyplaymaker on March 01, 2024, 07:23:48 PM
lol exactly e get some topic u go just see you go tell your self Omo nah only learn I go fit learn from this post I nor think say I go fit interact. And most people can relate to this. So just get some post wey be say the only thing u fit do nah to learn from it.

The two users wey been filling our local board withnl such type of posts have been given some levels of warnings - and for since when they got the punishment for spamming they have refused to logged into the forum again. This should stand as a warning to others unlike Bitcointalk local board that doesn’t have moderator this one has a moderator that’s actively trying to keep the board clean.
That actually nice, because in such forum that requires post count to rankup alot of users expecially newbies would be finding all means to rankup fast which may cause spamming and shit posting (posting off-topic or something not contributing). We'll have been in this forum for quite long and Haven't seen shit poster in our board that much , the moderator here is actually trying in keeping this our board in check.