With de wey hunger and inflation dey do partnership 4 dis country, even de hardworking self don dey tire 4 de mata. 500naira no b 500naira again, 1000naira no be 1000naira again. If u fit chop 3 square meal everyday, den u join de piple wey dey live another life 4 wi country. Na y i dey salute all hardworking piple, especially those wey dey hustle, cum still dey invest sum portion of their hustle 4 Bitcoin or others.
I remember watin sup last month, wen hunger finally reach de maximum height. I literally had nothing on me at dat moment. No b joke, bcus nothing dey 2 put 4 belle. At dat critical point, de only tine wey my mind fit fall back 2 na my crypto portfolio. Unto say i dey do HODL for most of dem, I tried denying myself from touching it. After contemplating 4 long, and i realize say na who dey alive dey do investment, i sharply sell sum take reduce de maximum height of de hunger. The mata no funny at all, because na sumtine wey anybody no go like experience.
In conclusion: After getting money from other source, I replaced de coin wey i sell sharply. Omo, de backup was indeed a sure backup. Christmas don reach, and i sure say some piple don dey do their mind. Definitely man must chop!!, man must survive!!.
Thanks for reading, and do well to drop a comment and also share ur experience if u av one.