Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: Igebotz on December 08, 2023, 12:25:22 AM

Title: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Igebotz on December 08, 2023, 12:25:22 AM
For those only teleporting to this forum today or this week, I've been here since Jan 2021, posted a few times but dey activities as of that time be no too gel as of now and with the whole censorship on BTT we hope we can build up another active community for here as we run am for that side.

I wan make we outline for dey do our thing, the admin dey very friendly and active and most of the things wey theymos denied us we go get am for here the way everything is setup here.

Abeg my people make una represent for this thread make we dey go jejely.
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: SmartGold01 on December 08, 2023, 12:37:33 AM

Truly me happy to come here because here be like another home for us and I know say many of us don too dey used to the other side, in fact Even me self na one person wey been no gree to put eyes here but as the gbege don be na we go stand attention take hold here gajad if not e no really pure for person eyes but still our people say Rom wasn't built a day. So na small small we go take get used to this forum even as we Mr T no allow us get things we supposed get onto say him dey buga for us I believe say we go get an here sooner or later.

About the activeness of the admin, me self surprised dey him carry respond to me immediately I send am pm I was like wow this is how admin should work and interact with people no be person wey go dey behave our village Otumokpo wey you go first pour almost one bottle of CHELSEA or kaikai before him go answer you. So this one self don give me joy like wetin no nice this night. Anyway me dey onboard to be carried.
We move!!
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Publictalk792 on December 08, 2023, 03:54:24 AM
Now I have one more forum to ask to understand to get more knowledge.
And we can make a good community. This forum is already a community but we will try to make it more best. Many are teleporting here.
3 days ago when I registered here. I was checking there were some posts daily and today. I was looking (today, today, today) word many time.
So I hope it will continue.
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Fivestar4everMVP on December 08, 2023, 05:38:01 AM
Lolz, you dey here since 2021, me dey here since 2020, Infact, make I even talk say, I started with this forum, I was actually the third of fourth person that signed up on this forum when it newly launched, the admin made me a global moderator back then.
But due to lack of activity, I became inactive, came back in 2020 when alot of have changed, I could no longer remember my username, password or even the email address I used to sign up previously, na then I decided to create this account using my btt username for easy recognition.
But you know like they say, "I get am before no be property" I go possibly contact admin to see if e dey possible to restore that my lost account.

I hail everybody here, most especially the op, him na my boss always, the sheriff himself, I am always loyal, I agree to everything wey you don talk, let's make this place a fun and better place to be..
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Wiwo on December 08, 2023, 06:48:56 AM
For those only teleporting to this forum today or this week, I've been here since Jan 2021, posted a few times but dey activities as of that time be no too gel as of now and with the whole censorship on BTT we hope we can build up another active community for here as we run am for that side.

I wan make we outline for dey do our thing, the admin dey very friendly and active and most of the things wey theymos denied us we go get am for here the way everything is setup here.

Abeg my people make una represent for this thread make we dey go jejely.
My brother my friend I thank you for this thread where you carry enter here for we to put month as in me sef dey among first people to register back then,  but you know how new something dey be na,  inactivity come make me lose out on few things and development as it concern this forum and beside me be no even dey active for both forum then.

But now we're reggae done dey change to blues,  na so me put eye back here make I see waiten dey happen for here,  I come see say my men done full ground for here dey make thing happen already and I commend you guys for that let make this forum more active. 
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Cryptsafe on December 08, 2023, 08:51:52 AM
My country people, I greet una for this morning. E good say we line up here to know ourselves better. Although e don tey wey I hear about this platform but based on the bases, I no too gbadu the pattern as e no dey much active like the other so I come like no reason the matter but now as e don be like this, I don show back fully teleported to make a difference. I think say of we bring our activities from btt forum here,e go make brain Wella say this our local board go move very fast already, we get child boards here wey go make our board well coordinated.
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Igebotz on December 08, 2023, 09:51:28 AM
<sinp>
I hail everybody here, most especially the op, him na my boss always, the sheriff himself, I am always loyal, I agree to everything wey you don talk, let's make this place a fun and better place to be..

Na why sometimes e dey good to save log details for Google cloud for the unforseen like this. Give me small time I go enter everybody for here and raise to the top with my Sherrif flag  :D

But now we're reggae done dey change to blues,  na so me put eye back here make I see waiten dey happen for here,  I come see say my men done full ground for here dey make thing happen already and I commend you guys for that let make this forum more active. 

Here get potential to stew with the kind activities wey dey go on now and the amount of teleportation wey dey go on from BTT. theymos banned two more Sig camp yesterday with immediate effect, him don dey become dictator for the forum, no more democracy.

@cryptsafe @Publicktalk792 una welcome
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Sokani on December 08, 2023, 09:58:06 AM
My Naija people I greet una and I dey happy to see some familiar faces here. This porting feature wey Altcointalks get dey very good and e make onboarding here very sweet. With the way people dey troop in to sign up, and if the admin go fit give the community freedom, the ban of mixer on btt na opportunity for alt to become more popular.
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Hatchy on December 08, 2023, 10:13:42 AM
Here get potential to stew with the kind activities wey dey go on now and the amount of teleportation wey dey go on from BTT. theymos banned two more Sig camp yesterday with immediate effect, him don dey become dictator for the forum, no more democracy.

I greet o boss, as una don show for the forum, I say make I still come represent my people for here Una Weldon boss. I happy say we don dey reach this side wella, as e go still drive more traffic reach this forum as from d look of tins e no dey active atall. But as we don dey here now, we go put am for motion.  ;D
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Roseline492 on December 08, 2023, 12:17:56 PM
For those only teleporting to this forum today or this week, I've been here since Jan 2021, posted a few times but dey activities as of that time be no too gel as of now and with the whole censorship on BTT we hope we can build up another active community for here as we run am for that side.

I wan make we outline for dey do our thing, the admin dey very friendly and active and most of the things wey theymos denied us we go get am for here the way everything is setup here.

Abeg my people make una represent for this thread make we dey go jejely.
Thank you for the introductory speech, just as you talk am, I get strong feeling say this place go sweet for because in as much as this forum they similar like the other one but I like the way the admin and moderators they do here and actually I also have a strong feeling say this forum way we they so, go favour us wella.

Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Mate2237 on December 08, 2023, 09:03:01 PM
We done come here be that oh. E be like say this place go sure passed oohhh. My bosses from other house una doo. As e be like dis and as sir Igebotz tok di benefits wey dey here go plenty passed that side and make build house very strong for here too. I stand strong for here. Make we move the mountains for here oh.
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Igebotz on December 10, 2023, 11:45:14 PM
Thank you for the introductory speech, just as you talk am, I get strong feeling say this place go sweet for because in as much as this forum they similar like the other one but I like the way the admin and moderators they do here and actually I also have a strong feeling say this forum way we they so, go favour us wella.

Yeah the admin dey try for activeness although the place no too get much traffic like BTT but I believe say with time everything go dey alright.

We done come here be that oh. E be like say this place go sure passed oohhh. My bosses from other house una doo. As e be like dis and as sir Igebotz tok di benefits wey dey here go plenty passed that side and make build house very strong for here too. I stand strong for here. Make we move the mountains for here oh.

Betterment go full ground for here sooner or later na make everyone just dey try keep account active and keep a good Karma score cause it matters for Ranking as nobe only activities go rank you up for here. For us wey go start our hustle Soon we go like if una go dey drop or two topics for here to keep activeness
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Obari on December 11, 2023, 05:50:45 AM
The sheriff, you’re doing well and I Dey commend your selfless service and I pray you never give up and I like the force and pressure men Dey use turn up for here which is a clear sign say here go soon clear and with the help of mixers, I believe a lot of traffics go Dey staged down here and since we no Dey carry last, we don already mount our guard dey observe.
But before I off this mic, I never see Brainboss for this side Abi oga never teleport ?
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Igebotz on December 11, 2023, 02:03:49 PM
I never see Brainboss for this side Abi oga never teleport ?

Him dey available but not active yet

https://www.altcoinstalks.com/index.php?action=profile;u=78947
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Makus on December 14, 2023, 07:31:07 PM
My people I greet oo, I just dey try to teleport my account from bitcointalk, as e be say the updat just dey reach my hand. Omor this forum wan be like Bitcointalk before but some kind things come change.based on my experience for Bitcointalk e come dey easy to fit understand the forum. Thanks to igebotz for the link to take teleport, baba I greet oo.
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Nheer on December 15, 2023, 08:08:25 PM
As i de see names wey de familiar con de sweet me for belle cos as i join here few days back i bin think say e go be lonely world for me but i just realize now say my people still choke for here too so i no get anything to worry about. Bitcointalk na nice forum wey don really help improve person crypto knowledge and i get believe say here no go different even though activities for here no be like that side but together we can make things better. I greet una mehn dem.
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Gormicsta on December 16, 2023, 12:13:50 AM
For those only teleporting to this forum today or this week, I've been here since Jan 2021, posted a few times but dey activities as of that time be no too gel as of now and with the whole censorship on BTT we hope we can build up another active community for here as we run am for that side.

I wan make we outline for dey do our thing, the admin dey very friendly and active and most of the things wey theymos denied us we go get am for here the way everything is setup here.

Abeg my people make una represent for this thread make we dey go jejely.

I don already dey observe the forum since I come and I see am say the forum make sense and wetin e just need nah time, e go do everything wey BTT dey do, but e go also make sense say the forum go also get team wey go dey do promotion for them, that way them go reach out to more people make them for take out interest here for the forum too. How you see am?
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Nwada001 on December 19, 2023, 08:06:11 PM
I say make I also locate my people for here make I see how things they be, I know even no say thread like this self come board where people fit come identify their self base on the teleporting level.

I happy to see most of us here and how we even get active moderator for here and the sun-board nah one thing way they give me joy pass for this local board way I discover.

Normally sha I been no no say we get local board here until I been see the boss Igeh comment for meta where eh they put am clear for person body as per how nice this place be and the part say him be moderator here way make me carry the leg trace am come here come meet my people where them full ground.

Abeg make onah show me my seat make I seat down Biko drink my Budweiser in peace 😁😁
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Cryptomultiplier on December 22, 2023, 05:13:13 PM
As much as I dey happy to see my fellow teleporters here, I hope say this side no go dey too difficult to navigate and gain from, because at a time, btt forum just come hard to earn even the smallest merits or even join any campaign despite how long person don dey for the community and dey active join.
This new mixers ban led to this teleportation and it actually affected my campaign like some others and truly December plans don spoil like so. E take me guts and a bit of encouragement from myself to even try complete the teleporting and dey try despite the catcha challenge to understand and follow up as I fit do.
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Hatchy on January 01, 2024, 07:15:25 AM
With so many teleported members from btt, na just few members dey active for this platform. E no sharp at all o. We need to keep this side active also because e go really make sense if traffic still pack come dis side and then better campaign go still show for here. The idea na to earn from two websites which I see say na correct idea. Abeg make we still try dey post for we local board to keep the place active.
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Maestro75 on January 13, 2024, 05:35:17 PM

Na run I take enter here to answer present o. But the confusion no be small thing like this. Many things come be like say them no too arrange like where we deh come from. I deh find am difficult to get where things them deh here abi e bi like say so many topics and subboards full here pass our other forum. This Karma thing self deh confusing. But I no go fear because I know say within a week or so I go get used to this forum also. I greet all of una here.
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Sim_card on January 14, 2024, 11:46:58 AM
I greet everybody for here, as I say make I come identify myself with my blood them. I actually forget say Naija board dey here and since 1st of January wey I don dey active for here na just two days ago I say make I also find my people come here. This forum dey very nice as he gives up room to also get anodaplace to share ideas apart from Bitcointalk. I don dey understand the forum boards and I dey navigate easily now unlike the first day wey na only two boards I just dey contribute for. Together we can make this place grow.
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Samlucky O on January 26, 2024, 06:58:23 AM
For those only teleporting to this forum today or this week, I've been here since Jan 2021, posted a few times but dey activities as of that time be no too gel as of now and with the whole censorship on BTT we hope we can build up another active community for here as we run am for that side.

I wan make we outline for dey do our thing, the admin dey very friendly and active and most of the things wey theymos denied us we go get am for here the way everything is setup here.

Abeg my people make una represent for this thread make we dey go jejely.
No be small o, here just be like under world for seasonal film lolz. I just dey lazy to come this place but I don make up my mind to come see wetting dey happen here. The interface dey nice and lovely and I like the way dem carry arrange everything here. E come be like person na novice for here. But anyhow E be guy man no dey miss road hehehe. Ona Weldon o.
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Igebotz on February 08, 2024, 03:54:24 PM

baba you never get motivations to pot na why your activities be like Nepa so but the truth be say if you no put efforts now e fit worry you sha as everybody just dey hustle now as e dey hot, give back to the community and earn some positive karma now wey e dey soft to earn. we want make una try dey give back to the local board make we cordinate here to meet expectation so that we go get slots for campaigns. check some of the pinned posts you go see some useful information
Title: Re: Newly Teleported Members Report Here
Post by: Jay-Jay247 on March 15, 2024, 01:57:36 PM
Good afternoon everybody, I greet una double double.
I just dey teleport my account here today as na just now I dey get the update from my gee, so I hope sey everywhere sacracum the wey I hear ram before I signed up.