Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: Abiodun on March 06, 2019, 09:36:39 PM

Title: Why market no dey always stable this days?
Post by: Abiodun on March 06, 2019, 09:36:39 PM
Great people, Abeg I dey confused this days about this market situation, the volatility wey dey always dey around bitcoin this days dey too much, and I no know why all this whales we get plenty Bitcoin dey always make the market volatile, Abeg how person fit still trade under this volatile market?
Title: Re: Why market no dey always stable this days?
Post by: Fatiti on March 18, 2019, 01:49:09 PM
Market no dey always stable this day because of the manipulatios wey dey always dey cryptocurrencies market, I believe say when them approve ETF market go soon dey stable wella
Title: Re: Why market no dey always stable this days?
Post by: poles1469 on August 13, 2021, 05:25:22 AM
not stable due to dbx token
Title: Re: Why market no dey always stable this days?
Post by: Coinmama7824 on January 22, 2024, 01:49:25 PM
For me, why I think say market no dey stable this days na because of the Christmas wey just pass so everybody dey try to take break and January dey always dey somehow.
Title: Re: Why market no dey always stable this days?
Post by: Bodhi2021 on January 23, 2024, 11:48:29 AM
Has for me the reason why market is not stable is due to say the economy no get value like before again things no balance and the cost of living done high, people way get money they rich everyday and the poor are getting poorer. But make we just they pray and keep trying we hope things go get better soon.
Title: Re: Why market no dey always stable this days?
Post by: Sim_card on January 23, 2024, 11:51:59 AM
For me, why I think say market no dey stable this days na because of the Christmas wey just pass so everybody dey try to take break and January dey always dey somehow.
Market no dey stable because bitcoin dey volatile in nature and the price need to dey go up and come down. Currently, the market dey on correction stage because the way wey the price of bitcoin run reach $48k+ this year, e dey strange. Another thing be say from observation of past history, if the halving don dey near, bitcoin price dey dip so that make, e the price for fit bounce back and surpass the last ATH for the next bull run. Grayscale dey sell off some of their bitcoin and I think say this fit dey among wetin dey affect the price of bitcoin, wey make am no dey stable.
Title: Re: Why market no dey always stable this days?
Post by: Igebotz on January 23, 2024, 03:55:59 PM
Don't bump old topics. Locked.