Well, I know say many of our people Dem wey dey btt go don already know about d reason, why Via btc no longer dey work well like before. D tin sef still shock me as I be dey think say Dem don stop Dem free services not until person come talk for btt forum say na all those ordinals people Dem dey use bot take fill up all d free transaction for viabtc. Me I just tire and na dat wan be d only free accelerator wey I be dey aware of. We no say transaction fees no dey come down anytime soon and dat wan na still becos of same ordinals Dem. I hate Dem like dis Omo.
Abeg my reason for dropping dis thread na to ask, if people for dis forum know any other free accelerator wey person go fit use Tay run transaction. Abeg if u know make u drop am for dis thread. Abeg no drop scam or spam for here becos I know some other rubbish accelerator and some wey still be scam. Abeg help ur people Dem.