Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum
Local => Nigerian Languages => Topic started by: tonymillions84 on March 07, 2019, 06:03:42 PM
-
abeg we get any person or people or even company wey dey try or run any cryptocurrency project. i don't tire to promote oyibo project. make we look for home made. it go better if we work to promote urs too. the next innovation na from blockchain. we niaja no dey carry last.
-
A Nigerian crypto project de up and running now. This project start since last year, and their ICO de on now. See their link here: dexage.io. Them been do airdrop too ohh, but I nor know if their airdrop done finish.
-
Yeah, many Naija projects dey onboard too, like the one dey market and functioning wey hin name na Abj coin, But one thing about all this Nigerian coin be we Nigerians no dey like something we comot for we country. I like the fact say you like and embrace our own projects and as e dey go so the way Nigerians dey involve for this CRYPTO space dey amazing and we need a good and working project wet go fit stand test of time.
-
abeg ABj coin na scam. they don exit before and come back to steal more money from people. it is clear they get no plan. just like BBcoin wey be naija project. i wonder wethin happen why they no last past one year. we come dey hear different story abou their project.
-
I think that Abj coin na scam too. But most of the crypto project we get for this country na crypto exchanges.
-
I no know the reason why most of our Naija projects dey fail, is it that we no fit keep up with the kinda projects other people from other countries dey do, na the time we we need to dey relevant for crypto space oo, else we Nigerians go dey irrelevant for the space.