Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum
Local => Nigerian Languages => Topic started by: Fivestar4everMVP on September 23, 2020, 12:25:03 PM
-
Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef
Meaning:Just be patient. Let the game come to you. Don’t rush
Akara and moin moin get the same parent na wetin dey pass tru make dem diffrent
Meaning:How you start doesn’t matter, what matters is how you finish
NO matter how dark room wan be, man go still locate woman breast.
Meaning: There is always a way when something matters much
If life dey show you pepper my guy make pepper soup
Meaning: Make something good out of a bad experience
Feel free to add yours ??? ??? ??? 8) 8)
-
Anywhere wey ant gather, know say sugar dey there.
Lol. I dey like proverbs for our local language (pikin) e dey sound unique to me.
-
The ones wey dey funny to me most na all dz wise words Pete Edochie dey talk for movies....
1. The cow in a hurry to go to America will come back as corn beef.
2. When a goat laughs upon hearing that the lion is around, one needs to find out the kind of grass it has been eating.
3. Never open the door for an Armed Robber, let them break it, it’s part of their job
-
Omoh I no fit laugh again, no matter how room dark man go locate breast, omoh talk dey here oh... Haha I like that parable eh
• Ear way no dey hear something when them cut of the head the ear go comot
•Pikin way no want allow em mama to sleep himself no go sleep
• Wetin elderly man sit down see even if you climb iroko tree you no fit see m.
-
I have been meaning to do this for a while now but each time I get distracted and laggard. I want us to have an avenue of sharing some of our indigenous proverbs while still learning the crypto stuff.
— E don tey wey I be dey plan to do this thing here but each time too much distractions dey carry my mind comot from am. I go like make our area people share some of our local proverbs here with their explanations. I go put the proverbs in bold.
Share a proverb, and then put up its meaning. It will be best if the proverb is written in pidgin English.
Make I kick start am with some Warri flavour. Area!
Nor be today wey yansh don dey back.
Meaning: We are used to such a situation.
Dem nor dey tell blind man sey salt nor dey soup, you fit tell am sey oil nor dey.
Meaning: Obvious things don't need explanations
-
Well I don see this kind thread before for btt, but I get one proverb to drop here to make the thread active too.
Ones breeze blow, fowl ynash go open : that wan mean say no secret go fit hide for ever.
One man's food na another man's poison: that one mean say something wey you dislike go be another man best thing
-
Op, please correct the spelling of pidgin on the title.
-
Op, please correct the spelling of pidgin on the title.
Haha OP na the spelling error there na e be your own problem like this oo 😂
-
Poster, as other don talk e for good make you change the pidgin spelling, make you correct am so that we go know wattin to do, anyway I get one proverb to drop,
Proverb: Our people say, na who get big yanch naim know how e take dey heavy am
Meaning: you are the only one who knows what exactly your going through
-
1) only a fool uses both feet to gauge a river's depth.
Meaning: You don't enter a situation without giving it some thought first.
2) Knowledge is like a garden; it cannot be gathered if it is not cultivated.
Meaning: You cannot expect to gain anything from information if you do not put it to use. information is something you would not expect to have if you do not make an effort to get it.
3) The sweetest place for sugarcane is its joint.
Meaning: Despite their seeming difficulty, the good and pleasant things in life are ultimately worthwhile.
-
Don tey make I dey see dis pidgin proverb make I still drop this one e common well well
Better soup, na money kill arm:
The good things in life don’t come cheap.
-
Proverb: when you no get enemy inside house, no enemy out go fit hurt you
Meaning: you need dey conscious of wetin dey happen around you
Proverb: person wey snake don bite before no blame am if him run if him see old rope
Meaning: you need dey careful make the same thing no happen to you
-
If your mate dey mad also follow them mad so that them go cure everybody together at once because e fit reach your turn finished.
Meaning: Always go out to hustle with your mate as they are coming home with good cash you won't jealous of them.
-
Haha it is fun doing this here on this platform let me drop some proverbs from my Grand Pa too😛...
1. Proverb: Na where short man hand reach e go dry him cloth
Meaning: You no fit do pass yourself
2. Proverb: One broom stick nor fit sweep house clean
Meaning: Unity and collaboration is essential for achieving a common goal
3. Proverb: Fly wey no dey hear word nai dey follow deadbody enter grave
Meaning: Failure to adhere to instructions is destruction
-
Very interesting. We have this thread on our local board on bitcointalk platform and here it is. I am happy that we are promoting our language and proverbs to the globe through this medium.i believe other nationals are also reading this and would be interested in our pidgin language.
Let me drop this one here;
Proverb: Wetin elder see as him sit down, pikin no go see am even if that pikin stand or climb tree.
Meaning: Always listen and adhere to the advise of your elders.
Proverbs: No matter how water boil reach , with time e go cool down.
Meaning: Any how person stubborn reach, the person go calm down as the person dey grow mature.
-
Very interesting. We have this thread on our local board on bitcointalk platform and here it is. I
I saw the thread about African proverbs in Pidgin on this forum, Altcoinstalks which was created later after 3 months that it has been created on Bitcointalk. I remember that the thread was created by Fivestar4everMVP at the time so the search was easy for me.
Some Hilarious African Proverbs In Pigin (https://www.altcoinstalks.com/index.php?topic=171246.0)
-
Lion no dey born goat
Meaning: like father like son
One day breeze go blow, fowl yansh go open
Meaning: nothing is hidden under the sun
Cassava today fit be garri tomorrow
Meaning: no condition is permanent
Person wey borrow cloth, no dey dance for party.
Meaning: tread carefully.
-
Lean on me no be press me die.
Meaning: Don't overstretched your helper
Na condition make crayfish bend.
Meaning: Poverty will humble you.
-
Proverb : Water no dey they bitter just like that
Meaning: No smoke without fire.
Proverb: the stick wai go blind eyes, na for far they go stop pam
Meaning: Do the right thing at the right time
-
i. A frog dose not run in the day Time is either pursing something or something they pursue ham
ii. I no go teach you how to catch fish and you dey expect me make i teach you how to eat the fish.
Meaning: I won't found you a job and you expect me to come and teach you how to run the Job again for you.
-
Proverb: housefly way no get adviser dey follow corpse enter grave.
Meaning: whosoever that doesn't listen dies miserably.
Proverb: pursue little chicken fall, little chicken run commot.
Meaning: anyone that is planning evil thing against someone will befall evil.
Proverb: snake no fit born wetin no get long tail.
Meaning: like father like son.
-
Oh, I don see sey awa people don dey roll wit palm oil wey elders dem dey take eat yam for here, according to China Achebe. Dis wan good too as we dey take do am for d orda forum.
-
This one de interesting oh, awa own english too make sense sha, mostly when we come de use am for pidgin take de give proverbs
Proverb: Cut am, cut am na animal body
Meaning: When you keep taking from a particular place/person without replacing, that place/person won't be happy.
-
Oga @Stuart, the legendary member in the local board. Welcome back. When I first come to this forum and discovered our local board, na your threads I been dey see everywhere but as you no come dey active again newcomers threads dem come take over everywhere.
Hey oga Op you be old member here too ooo. See this thread na back 2020. No be Children play.
Where the elders stand dey see, the young ones e no dey see even if dem climbed Iroko Tree.
Meaning. Weti elders know, young people e no know.
That means una know more than us about the forum.
-
Old man/woman fit sit down see things wey even if a child climb tree him no go see.
Meaning: The elderly people are more knowledgeable and have more experience than the younger individuals
-
Old man/woman fit sit down see things wey even if a child climb tree him no go see.
Meaning: The elderly people are more knowledgeable and have more experience than the younger individuals
With the day the country dey go now ehn wetin small pikin dey see if old man like make he climb sky scrapper he no go fit still see am. Lol ;D
All jokes though, this proverb brings back memories from childhood when we used to hear things like this from our parents.