Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum
Local => Nigerian Languages => Topic started by: peperest4guys on December 05, 2017, 08:16:25 AM
-
D only tin wey dey burst men head na how to hammer......but una suppose know say the crypto world na b d biggest way to hammer faster now o......dis one nor b ponzi o.....dis one na correct dissentralized markets for marking of digital currency........na der I dey full time..... Oboi I dey wait una o......

My niggi, I hail you wella. For this tin u chipin now eh, most of our people no believe say crypto na sure way to make better cash, and that is why them de behind. Some still believe say crypto na ponzi scheme. Well I happy say you know. Oyibo say if you are not informed, you ate deformed. we way de informed na baba God na em grant am for us.
-
Make una no vex o! Che nah d same crypto way I dey abi una get anoda one way una dey talk about? If yes, a beg tory me make me set folo know the koko.
-
Make una no vex o! Che nah d same crypto way I dey abi una get anoda one way una dey talk about? If yes, a beg tory me make me set folo know the koko.
My chief, you nor know say nor be every Nigerians wey know or believe say crypto na better thing. Nigerians wey nor know say na ponzi scheme, but we wey know na luck we get. This bitcoin wey de down now na be the koko wey de so.
-
The way wey I take dey happy say I dey into crypto currency wprld na one of the best thing wey don happen to me for this world, say I be one of the early adopters na something, and make we dey pray say make bull run come fast. Make every where jollouf for us last last.