Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum
Local => Nigerian Languages => Topic started by: Thyplaymaker on December 08, 2023, 08:12:23 AM
-
Omo the rate bitcoin tey dey move so dey amaze me normally. But base on research I don do about others halving make don first take place before because this one nah the first I wan experience since knowing about cryptos. Abeg Una know Shey normally for all halving Btc go first experience dip before e go con skyrocket again. As things dey now Btc go fit fall below 30k$? Before e beat its ATH. Make I know nah make person nor go enter wrong time because of FOMO. Because as e dip the others coin will Bleed too.
-
Guy you talk truth sha and as e be so, this nah the best time for every individual to hold em coins for dear life.
Normally normally, as this halving done dey reach so, a lot of scammers go dey more active to scam those way just dey new for this crypto space, so the best thing for every investors nah just for them to shine their eyes and secure their coins with every bit consciousness way them get.
Although nah good opportunity for any body way really dey discipline to accumulate and hold them coin for bigger profits.
-
Abeg Una know Shey normally for all halving Btc go first experience dip before e go con skyrocket again. As things dey now Btc go fit fall below 30k$? Before e beat its ATH. Make I know nah make person nor go enter wrong time because of FOMO. Because as e dip the others coin will Bleed too.
The truth be say nobody know whether the price go drop or whether nah like this he wan just take Dey go up, so anybody wey tell you say he go drop or something go happen to am nah just speculation the person Dey and even the person nor Dey 100% sure say he go happen sef.
Nai make am we Dey always advise people to do DCA, that way even if the price drop or rise you go still Dey accumulate am small small instead of buying everything once - and also the average price wey you take buy all your coins go fall for good range if you put body for DCA. For this market dem nor Dey wait for one time if you wan hold for a long time.
-
Halving na one event wey dey happen to Bitcoin every four years, wey go reduce the reward wey miners dey get. Some people dey believe say the price of Bitcoin go fall just before the halving, and then go jump after the halving don happen. But me sef, I no sabi if this theory na true. E get many things wey dey affect the price of Bitcoin, so e hard to predict wetin go happen.
-
Halving na one event wey dey happen to Bitcoin every four years, wey go reduce the reward wey miners dey get. Some people dey believe say the price of Bitcoin go fall just before the halving, and then go jump after the halving don happen. But me sef, I no sabi if this theory na true. E get many things wey dey affect the price of Bitcoin, so e hard to predict wetin go happen.
Seyyy? Nah same thing me dey reason so but we'll sha due to the slight knowledge I've about Btc halving e dey always experienced a certain deep before the main bullish but we'll sha I get the feelings Shey this upcoming nor go too dey different from d rest and may be e might even boom pass the previous ones cos the way investors tey ready Bcoz four years nor be small thing Ohh so any opportunity make dey now nah to grab am.