Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: Anita805 on December 09, 2023, 12:18:15 AM

Title: I just dey come
Post by: Anita805 on December 09, 2023, 12:18:15 AM
Good day my fellow Nigerian brother and sisters, e never too Tay wey I just dey join this forum. And as I come see Place wey my fellow Nigerians dem dey, e just dey give me joy. However I go like make the baba Dem wey don dey since, abeg make una put me thru, so that I go understand wattin dey happen for this forum.
Title: Re: I just dey come
Post by: Agbe on December 09, 2023, 07:40:14 AM
Good day my fellow Nigerian brother and sisters, e never too Tay wey I just dey join this forum. And as I come see Place wey my fellow Nigerians dem dey, e just dey give me joy. However I go like make the baba Dem wey don dey since, abeg make una put me thru, so that I go understand wattin dey happen for this forum.
O girl dis place just dey confused person like tomorrow no dey. Well e no too difficult to understand if you were a active poster in Bitcointalk. You just have to select any board and check the threads and see if you can make comments and if you can then you drop your comments and if you can't you check another one. Na so e be. You are welcome to the second forum of Nigeria cryptocurrency world
Title: Re: I just dey come
Post by: Thyplaymaker on December 09, 2023, 11:41:28 AM

Lol Omo e no really easy for here oh that why  u need to dey active to follow up, exactly wetting this boss talk just find nice thread make suit u well, and make comments don't forget always post quality post.

According to the forum admin no spam post and all that. The few time I don spend for this forum dey fun and impacting normally. So wish Una well Ohhh Abeg make we dey try make this our Naija board active
Title: Re: I just dey come
Post by: Cantsay on December 09, 2023, 01:57:16 PM

According to the forum admin no spam post and all that. The few time I don spend for this forum dey fun and impacting normally. So wish Una well Ohhh Abeg make we dey try make this our Naija board active

This one nah normal thing for all forum nah, he nor get any forum wey you go go wey dem Dey accept spam nah.. if them too spam for the forum he go make so many people lose interest nai make admins Dey strict when it comes to spam.

Back to the Op, Omo this forum Dey confusing Aswr.. unlike BTT wey everything just Dey organized and you go easily see boards wey some kinds of topics Dey this one just spread full everywhere each coin get he own board. He go take time but we go still understand how things Dey work for here.
Title: Re: I just dey come
Post by: Sokani on December 10, 2023, 11:40:50 AM
Good day my fellow Nigerian brother and sisters, e never too Tay wey I just dey join this forum. And as I come see Place wey my fellow Nigerians dem dey, e just dey give me joy. However I go like make the baba Dem wey don dey since, abeg make una put me thru, so that I go understand wattin dey happen for this forum.
If you look closely on the profiles of some of us, you go see our date of registration dey new and the word "teleported" meaning that we are integrated into this platform from somewhere, so we self dey new for the forum and everything just dey strange for our eyes.
Title: Re: I just dey come
Post by: Obari on December 11, 2023, 05:55:17 AM
Good day my fellow Nigerian brother and sisters, e never too Tay wey I just dey join this forum. And as I come see Place wey my fellow Nigerians dem dey, e just dey give me joy. However I go like make the baba Dem wey don dey since, abeg make una put me thru, so that I go understand wattin dey happen for this forum.
O girl dis place just dey confused person like tomorrow no dey. Well e no too difficult to understand if you were a active poster in Bitcointalk. You just have to select any board and check the threads and see if you can make comments and if you can then you drop your comments and if you can't you check another one. Na so e be. You are welcome to the second forum of Nigeria cryptocurrency world
Even chairman say here Dey confuse , na e be say the common man don die be this and e shock me say a whole chairman Dey complain about confusion because legit, this place Dey more complicated than the previous place we been Dey and I agree with @Agbe say here wan stress mankind.
@op, no go rush to make post please, take your time go through threads and get familiar with the forum, time Dey wey you go use write and since you just Dey arrive, no go pressure your account but take your time read more than posting more.
Good luck
Title: Re: I just dey come
Post by: Hatchy on December 13, 2023, 02:03:42 AM

Normal, d place dey more complicated pass btt. But with time, person fit understand the forum. The idea be say, make we use small time take navigate all part of the forum and understand watin d forum dey all about. Yes e dey similar to Bitcointalk and so if u understand Bitcointalk well then this one go only leave u small stress to understand.
Title: Re: I just dey come
Post by: Yamzakid on December 13, 2023, 09:48:27 AM
Lol Omo e no really easy for here oh that why  u need to dey active to follow up, exactly wetting this boss talk just find nice thread make suit u well, and make comments don't forget always post quality post.

You are right it is not really easy here, but everything is determination because nothing good comes easy with time now, things will turn to memories. Based on what I've seen, this forum is simpler than bitcointalk. Only those who are actively participating on Bitcointalk get to save from suffering in this forum.
Title: How Una tey dey for here
Post by: Thyplaymaker on December 16, 2023, 12:02:33 AM
Normally Naija b nor dey carry last oh. But the way this our local board nor tey active nor dey sweet me at all. We suppose to dey active dey exchange ideas for here concerning cryptocurrencies. How person wan con tey learn for e local board wet nor active. Abeg make we try make here lively
Make use this medium ask how Una investment dey go for this bullish market?
Title: Re: How Una tey dey for here
Post by: Gormicsta on December 16, 2023, 12:17:13 AM
Normally Naija b nor dey carry last oh. But the way this our local board nor tey active nor dey sweet me at all. We suppose to dey active dey exchange ideas for here concerning cryptocurrencies. How person wan con tey learn for e local board wet nor active. Abeg make we try make here lively
Make use this medium ask how Una investment dey go for this bullish market?
Bro I dey solidly behind you, I been no even know say naija get local board here self wey I come dey find where I go dey lap steady, e sweet me no be small to know say we naija get local board here too, abeg make we join hand together make this board active, e no go bad say this our local board dey active pass every other board for here. E no go bad at all.
Title: Re: I just dey come
Post by: Gormicsta on December 16, 2023, 12:25:02 AM
Good day my fellow Nigerian brother and sisters, e never too Tay wey I just dey join this forum. And as I come see Place wey my fellow Nigerians dem dey, e just dey give me joy. However I go like make the baba Dem wey don dey since, abeg make una put me thru, so that I go understand wattin dey happen for this forum.

Welcome t he forum,
Me self e never too Tay wey I join the forum and I don already dey enjoy am, if you just dey dey active for the forum and for this our local board, you self go enjoy am. Hope you dey like your stay here sha, and if you get any questions or suggestions concerning the forum or our local board, just feel free to ask am here and people wey go answer you go dey.
Title: Re: How Una tey dey for here
Post by: Thyplaymaker on December 16, 2023, 01:22:03 AM
Normally Naija b nor dey carry last oh. But the way this our local board nor tey active nor dey sweet me at all. We suppose to dey active dey exchange ideas for here concerning cryptocurrencies. How person wan con tey learn for e local board wet nor active. Abeg make we try make here lively
Make use this medium ask how Una investment dey go for this bullish market?
Bro I dey solidly behind you, I been no even know say naija get local board here self wey I come dey find where I go dey lap steady, e sweet me no be small to know say we naija get local board here too, abeg make we join hand together make this board active, e no go bad say this our local board dey active pass every other board for here. E no go bad at all.
Omo you get the gist Omo local board dey nice to post you just dey free because you know Shey nah your people dey here.
Title: Re: How Una tey dey for here
Post by: Tribalchief on December 16, 2023, 12:03:02 PM
Unto say the ideas wey ninja piple get fit add values to each of us. But at least, make we still dey appreciate piple post b4 we make comments. Sometimes, de person post fit no solid: wich means u fit no agree with am, but instead of u 2 insult am indirectly, just politely correct am by giving ur own opinion. De idea of making piple's post looks stupid should be Discourage.
I greet de house ooh!!!.
Title: Re: How Una tey dey for here
Post by: Makus on December 16, 2023, 12:44:41 PM
Normally Naija b nor dey carry last oh. But the way this our local board nor tey active nor dey sweet me at all. We suppose to dey active dey exchange ideas for here concerning cryptocurrencies. How person wan con tey learn for e local board wet nor active. Abeg make we try make here lively
Make use this medium ask how Una investment dey go for this bullish market?

U no say people never many for here and some of them sef wey don come here still get other account for other sites like Bitcointalk so Dem go dey very busy com join their normal life activities, so I go like make we exercise patient small, before you go know we go come gather for here in full force to shake the forum, I believe my country and I know say we no go fit take last, na just time we need.
Title: Re: How Una tey dey for here
Post by: Yamzakid on December 16, 2023, 02:12:28 PM
Make we no worry na because people never too notice this forum the way them notice bitcointalk, I dey feel bad as people no dey too yarn for here sha but I know our people they go turn up soon and beat the other boards. Sometimes ehen person dey get better discussion about cryptocurrencies but how you wan take discuss
am for this board wey we no dey dey active.
Title: Re: How Una tey dey for here
Post by: Coinmama7824 on December 16, 2023, 05:18:07 PM
Make we no worry na because people never too notice this forum the way them notice bitcointalk, I dey feel bad as people no dey too yarn for here sha but I know our people they go turn up soon and beat the other boards. Sometimes ehen person dey get better discussion about cryptocurrencies but how you wan take discuss
am for this board wey we no dey dey active.

Na true talk you talk, na just time e go take, with time this place go start to dey bubble,
For me, na our naija local board I dey mostly feel free to express myself more than every other board, and e go really make sense say this our local board go dey busy and interactive, I don see am say we get plenty naija people for here, so make we just try make we grow this our board.