Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: Youngkhngdiddy on December 18, 2023, 01:01:49 PM

Title: Links flying around
Post by: Youngkhngdiddy on December 18, 2023, 01:01:49 PM
My pipo na just small advise I carry come this period wey we dey na desperate period because people dey one dey in urgency to make Money as if na deadline so make we dey careful about all this links way dey fly around make Dem no go job ur money from your bank account or even hack ur Facebook accounts or make ur IP go cast or even hack your Gmail that one now most pipo password dey saved inside sef I remember 2017 this kind period nai I lost almost 20k because of negligence and eagerness to double my money with one kind fake site wey Dem post for Whatsapp group like that so my pipo if you dey click any link dey very sure of it  before you do it no try to experience wetin some of us experience because e no go nice at if you fall mugu for this cheap scammers.
  Different ways dey for hacking at the moment, w con be like say every body just dey vulnerable to threats. Nobody sabi the means or approach wey these hackers go use, Dem fit use means wey seem very very promising and just random but e dey always dey cunning if we look deep, but we no go too sabi based on say na something wey dey normally do.
  Everybody jus gats dey up to date to the fact say people dey use the littlest of means to gain access to our personals. We see instance of links from Whatsapp, addition to unknown groups, and even sms of downloading a file. Any mistake to opening those links are just gateways to our files and documents being exposed to those bad people. The world dey evolve and so different means to causing harms to people's privates just dey emanate and one just has to be cautious in whatever they're doing so as not to get hooked up in the dangers that would arise once the threat becomes an attack.
Title: Re: Links flying around
Post by: Coinmama7824 on December 18, 2023, 04:54:36 PM
Omo wetin all these scammers don do me for this life ehh, me I no fit forget am, but e go hard before them go fit succeed to scam me again cos I don study them well well and I sabi their ins and outs.

Na so those mumu them take comot my 60k wey I supposed use pay school fees, around 2020, Omo my just send me money like that, e no reach 5 minutes after I receive the credit alert, na so I receive debit alert asap wey make me loose my 60k, ask me how them take move am, I no know, I even go bank go check for the aza them move the money go, even bank self no fit tell me, Omo I wan die. Since that day na e I stop to dey click any link wey I just see, if no be trusted link, Omo I no click oo