Oya, make una chuck mouth for this matter...
How far my fellow Gs and Ls..Abi dey run am before all those mining stuff dey quick dey tire me bcus sometimes dem go use Kyc tey discourage u, I was mining this one and some others I stopped due to Kyc dem go give something make go hard you to do b4 u go fit do Kyc. I think say na that one dem tey dey filter the quantity of pipo make dey run am. D thing go well sha bcus dem to hype am wen e come out
How una take see this Avive token wey won launch today, na only few hours remain for the token to get listed on okex exchange.(https://talkimg.com/images/2023/12/19/Eemw3.png)
- How una don prepare for the listing?
- Wetin be the price wey you dey expect to sell your Avive
- How you rate the project overall?
And again, how far, you don see your Avive kyc score point.? My own na 89.5, just 0.5 remain for me to enter 90 wey for allow me get 30 percent of all the avive token wey I mine..(https://talkimg.com/images/2023/12/19/Ee6Ew.png)
Oya, make una chuck mouth for this matter...
Ahh, boss, to be honest, just like I be don talk for that our group, be no too mine plenty because right from the beginning, I no take them serious, I only managed to mine close to 2000 Avive tokens, so based on the 15 percent wey they Don release give me, I don sell am sha, but the money no even reach anything because the price is just around $0.122 or a little above.Oya, make una chuck mouth for this matter...
How many total wey you mine? I look at the project and some persons still dey struggle to pass the KYC and saw alots of complain too.
Damn Omo moni dey the stuff Ooh I b nor dey vibe am like that again cos most of them go use that Kyc tey dissapoint person or end up being a scam project. But thank God Shey Una gain from avive I b dey mine but I stop too early.Ahh, boss, to be honest, just like I be don talk for that our group, be no too mine plenty because right from the beginning, I no take them serious, I only managed to mine close to 2000 Avive tokens, so based on the 15 percent wey they Don release give me, I don sell am sha, but the money no even reach anything because the price is just around $0.122 or a little above.Oya, make una chuck mouth for this matter...
How many total wey you mine? I look at the project and some persons still dey struggle to pass the KYC and saw alots of complain too.
Na people way take the mining serious na them get luck, like for my area here right now, one guy just dey pop bottle anyhow anyhow, the guy mine over 200,000 of the token, dey release 15% give am which is 30,000 tokens, the dude Don sell am cash out around 6.3 million naira, and this na him first ever crypto currency, he no dey into crypto before, na him place I dey like this to follow him celebrate.
I follow mine this coin too and I get 30% of my own coin bit the truth be say I been no too reason am so I no come give am that attention until my friend wey relate am to me inform me of the development before I come take am a bit by serious. I scale through the KYC successfully them send me my coin twice for okex but the price no go well sha. But on how e be, I dey hold till I see say the matter go well before I sell.Na true you talk sha, the price if the token no too go well, most especially for those wey no mine the token plenty, like in the tens of thousands or even possibly, a hundred of thousands, because, I know say people wey mine up to this amounts wey I mention are still in money regardless say the price of the token don drop significantly.