Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: Sokani on February 01, 2024, 05:45:30 PM

Title: Username colours for chatbox and online status
Post by: Sokani on February 01, 2024, 05:45:30 PM
Some of us dey new here, and things never really clear for us as we still dey learn new things about altcointalk. Maybe some of us don observe say di forum member names for the chatbox and also users wey dey online, the names dey appear in different colors. So dis post na to point out the colors for the various ranks, so that when next you see a particular colour, you go know which rank the user be and you no necessarily need to go peep for the profile to find out.

Blue - Newbie, 1st Step, Baby Steps, Jnr. Member, Member, Full Member, Snr. Member

Pink - Hero Member

Brown - Legendary

Green - Mythical

Purple - Padawan

Red - ***Admin, President, Vice President

***Dem no be rank

If e get any of them wey I miss, make una let me know.
Title: Re: Username colours for chatbox and online status
Post by: Thyplaymaker on February 01, 2024, 06:47:12 PM
Some of us dey new here, and things never really clear for us as we still dey learn new things about altcointalk. Maybe some of us don observe say di forum member names for the chatbox and also users wey dey online, the names dey appear in different colors. So dis post na to point out the colors for the various ranks, so that when next you see a particular colour, you go know which rank the user be and you no necessarily need to go peep for the profile to find out.

Blue - Newbie, 1st Step, Baby Steps, Jnr. Member, Member, Full Member, Snr. Member

Pink - Hero Member

Brown - Legendary
 
Green - Mythical

Purple - Padawan

Red - Admin, President.

If e get any of them wey I miss, make una let me know.
wow nice!!! I haven't taken notice of this since being in this forum. Omo for you to take notice of such thing you really dey observant ohh. And alot places dey this forum make I never even go seff. I still got alot to learn and explore in this forum.  ;D
Title: Re: Username colours for chatbox and online status
Post by: Agbe on February 01, 2024, 07:22:06 PM
Op this one na very good observation. I don dey see this colors since but I never noticed am like that that one na good differentiation. I never even see di rank "Purple - Padawan" before. And as you don bring am to our notice we go dey follow up now to identify them with the colors.
Title: Re: Username colours for chatbox and online status
Post by: Tribalchief on February 01, 2024, 07:34:06 PM
I really happy as you point this things out. The chat bar na watin i done use, but no dey too use am base on say I no dey too get important questions to ask. Those colours never come my mind before, but I done note them to heart now. Abeg try to also share some further observations, so dat we go dey note them one by one.
Title: Re: Username colours for chatbox and online status
Post by: DaNNy001 on February 01, 2024, 07:42:25 PM
Interesting observation, I haven't really notice any thing well atleast not until now that you have started this and you must have really kept a kean eye to have notice this atleast now I will add it to my dictionary of things about the Altcoinstalk community. I know there are more updates like filled in this community that most users are unaware of like the modification steps that can enable you set up your account in very much more convenient way and use of it.
Title: Re: Username colours for chatbox and online status
Post by: Cantsay on February 03, 2024, 01:33:13 PM
And me be Dey reason say nah a way to different different users for the chatbox.
So many things just Dey this forum wey we think say nah just norms but all of them get meaning behind them - who see am go think say nah to just spice the discussion for there not know thing that it actually represents something even better.

That means say if I make post there now my own username go be pink,I go see if I fit reply any thing for there make I observe if nah actually true.