Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: Mr. Allcrypto on February 20, 2024, 11:35:02 PM

Title: Wetin dey sup ?
Post by: Mr. Allcrypto on February 20, 2024, 11:35:02 PM
My 9ja brothers and sisters, una shore say this economic crisis wey dey sup for our country go end? Because e com be like prices of things dey change morning, afternoon and evening...e kuku remain make we dey pay for the air wey we dey breath o, lol... cost of living wan kill the living for our country, abeg make una dey shear updates make everybody no turn armajiru enter streets.
Try shear update so we fit shear funds o, cuz our people Naim talk say one car no fit form convoy. Show love to people this period o, we go survive sha, on God.
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Tribalchief on February 21, 2024, 05:11:21 PM
lol... cost of living wan kill the living for our country

Hummmm, wisdom wan just finish you  ;D. If no be say Nigerians na happy people ehhn, we for no dey talk all this matter now. We just Sabi endure, manage different situations and adapt. Say na US all this ones for dey happen, protest for done burst.
Though, I think the government done dey push the people to the wall.
Quote
Try shear update so we fit shear funds o, cuz our people Naim talk say one car no fit form convoy. Show love to people this period o, we go survive sha, on God.

In the aspect of update, I think e dey common among Nigerians to hide update, though some people are willing to teach others what they do. It's better to share a profitable update than to give out money.
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Igebotz on February 21, 2024, 05:21:02 PM
Wondering why you abandoned your previous topic https://www.altcoinstalks.com/index.php?topic=317557.0 to create this one. They're the same. I'm going to merge both topics.
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: goaldot on February 25, 2024, 06:55:50 PM
No be small thing oo. For my area now na another thing. Everything in the market dey rise per minute. If you enter any shop, the owner go first make call before en go tell you price. Before you pay en go call another shop owner to know if price don change.

You dey talk of show update, is only for person wey dey crypto. Our people want quick cash.
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Agbe on October 28, 2024, 10:57:55 PM
The situation is getting worst by the day as the inflation in the market is getting worst by the day, and looking at the situation there's no hope yet as those in power seems to lack the capacity to solve the problems of the country. Nigeria as a country is at a cross road because everyday that passes by the price of goods and services is on the increase with no fixed priced things are even worst now that subsidy has been removed from fuel causing the price of goods to scaroket in the market making it extremely difficult for the ordinary Nigerian to survive with people finding it hard to eat three times a day.
People should look beyond government and start investing in good business that can give them money that is why we encourage people to always invest in crypto currencies like Bitcoin, entherium etc as crypto currency is now the future of the worlds Economy with it's fast acceptance and growth in the country. Bitcoin has a bright prospect and market value that keeps appreciating everyday
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: rachael9385 on October 28, 2024, 11:30:28 PM
We all know say things dey cost and e dey affect all of us no be small thing, until market people sef come dey confused for the price when then go take sell their market again, if u buy matches here 50 naira u go another place na 30 naira u go another place na 40 so u see am na we too take dey make things cost for us
Especially young boys, I see one nigga wey carry iphone x still dey beg person for money 100 naira for card, u no get money u dey like big things as a low class financial person ur own na to try adapt to the economy situation no be to belong too wetin others do.
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Obim34 on October 29, 2024, 08:36:37 AM
Everybody just dey live on God, apart from food wey most people dey hustle nothing dey fit just account for,  some no savings, no investment, some people just want fill their stomach then find where they fit rest their head for night to sleep. This na wetin the country done turn us into, even with all the planning wey man go do finish, no way to implement because of how bad the economy they go.

I believe say we go get better, one day wey our eyes go tear finish then we go understand say time for suffering don end and nah time to take strict action against the politicians wey dey make living difficult.
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Agbe on October 29, 2024, 08:50:04 PM

Try shear update so we fit shear funds o, cuz our people Naim talk say one car no fit form convoy. Show love to people this period o, we go survive sha, on God.
  Yes with the way things are now there's need for people to share update and keep others inform because we are in a crucial time as a country.  Sharing of information is key as it will go a long way to make people know what is new and OPPORTUNITIES that are currently available. One of such opportunities is gambling, gambling is what many Nigerian has fallen back to as the economic situation is getting worst with no hope of things getting better, gambling is what is sustaining allot of people because gambling is a profitable business to go into
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Chilwell on December 15, 2024, 11:49:13 AM
As he be now the country no balance at all oo. Everything don turn upside down, people dey really suffered for dis hard economic, even garri Don turn to gold, I just pray make everything go back to normal as den be before, becos e good make we dey think positively about the situation, make we no bad mouth the situation, make we no think say things go never dey OK again oo. Because as for me, I no sure whether things go, go back to normal again, But I still dey hope so. My country people make we no lose hope ooo, last last everything go dey alright.
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Nheer on December 15, 2024, 03:55:51 PM
My 9ja brothers and sisters, una shore say this economic crisis wey dey sup for our country go end? Because e com be like prices of things dey change morning, afternoon and evening...e kuku remain make we dey pay for the air wey we dey breath o, lol... cost of living wan kill the living for our country, abeg make una dey shear updates make everybody no turn armajiru enter streets.
Try shear update so we fit shear funds o, cuz our people Naim talk say one car no fit form convoy. Show love to people this period o, we go survive sha, on God.
Bro this country na just crises upon crises, everybody don tire with this government wahala. People wey suppose voice out just lock up aswr. Everyone just dey do like say them no know wetin dey sup for this country but by god grace each citizen will never lack we will always get through what ever situation the government put is through either good or bad we will go through them by God grace. Omo every body just dey look for better opportunities make them find way comot from this country the economy is bad oo but still people are going out of this same country everyday we pray out better days come running to us too.

 You been dey talk about update Omo things sef no just easy again, people no wan gree teach others, they don’t wanna carry their bro along all they want is others calling them boss we just they hope for better people’s and better life. Even if you share update about this forum so people no go still do they need quick money and fast money they no want they wait like months to get campaign all they want is just have the money so fast. I been show person about this forum but he say he don’t have time for waiting to get campaign he rather continue his yahoo work lol I just dey look am if person get campaign for this forum na money oo aswr but my guy no gree join despite the weekly payments 🤦🤦
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Rruchi man on December 18, 2024, 07:26:38 PM
cost of living wan kill the living for our country, abeg make una dey shear updates make everybody no turn armajiru enter streets.
Try repositioning yourself as someone who is not just a consumer; identify a need around your environment and start a business with the aim to meet that need. You will be amazed at the profit you could make. Also, If you already have one source or income, you also do not need to relax there because the economy is being affected by inflation and you cannot afford to be caught behind, you need to quickly seek out extra sources to make money from.
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Mia Chloe on December 18, 2024, 08:26:25 PM
Try repositioning yourself as someone who is not just a consumer; identify a need around your environment and start a business with the aim to meet that need. You will be amazed at the profit you could make. Also, If you already have one source or income, you also do not need to relax there because the economy is being affected by inflation and you cannot afford to be caught behind, you need to quickly seek out extra sources to make money from.
Self employment is definitely one of the biggest moves you can make in situations of economic issues like this. The fact is in a country like this you can't actually risk having a single stream as your source of income with the way inflation is eating deep into the economy. Although self-employment is a better resolve than being employed as a private or public worker , it still packs some risks and drawdowns.

One of these drawdowns is increase in price and it mostly affects those that sell goods more than those that offer services. you find out that gross profit from a sales batch may become short when trying to purchase the next batch after successfully selling off the previous one.
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Sim_card on December 19, 2024, 05:54:45 PM

Our country is in an era of creativity and self employment. You need to take advantage of your environment and exploit with your skill or with your income to invest in a business. Depending only on your job will turn you to a beggar in future, because the economy is getting worst and inflation is getting higher.
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: DragonF on December 20, 2024, 12:03:03 AM
E dey surprise me say since wey the OP create dis topic till now so many months don pass but we still dey suffer for this countri and the suffering don even increase. I no sure say anything go good at all. We don dey approach Christmas and I just dey wonder if people go fit chop Christmas rice because as usual price of things go even increase.

I happy as the Rivers State Governor Sir Sim Fubara don talk about Christmas discount market so that everybody go fit buy wetin him go chop for Christmas but dis good thing fit no end as e suppose bcos some selfish politicians go buy everything den go preserve am to use am during election time for campaign. So, I dey suggest say make government supervise the discount market so that e go really reach poor people.
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Mia Chloe on December 20, 2024, 08:40:58 PM
Our country is in an era of creativity and self employment. You need to take advantage of your environment and exploit with your skill or with your income to invest in a business. Depending only on your job will turn you to a beggar in future, because the economy is getting worst and inflation is getting higher.
Yeah you do have a solid point man. The only way the hardship may not hit you hard is if you earn a very huge amount and you work with a firm or the government ina position where you get alot of allocation for allowance for majority of the things you actually need.

The rate of hardship of the country is part of the reasons  why most Nigerians find it very difficult to save because you find out that both savings and investments require you to have an extra or spare cash.
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Penlex_Writer on January 11, 2025, 10:07:24 PM
My 9ja brothers and sisters, una shore say this economic crisis wey dey sup for our country go end? Because e com be like prices of things dey change morning, afternoon and evening...e kuku remain make we dey pay for the air wey we dey breath o, lol... cost of living wan kill the living for our country, abeg make una dey shear updates make everybody no turn armajiru enter streets.
Try shear update so we fit shear funds o, cuz our people Naim talk say one car no fit form convoy. Show love to people this period o, we go survive sha, on God.
the crisis for our country i no sure say e go end oo,because e don tey before them born us,some generations go don meet am go,the leaders just make life for the country tire us,e go better e go better no be today we don they hear am.
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Joshikinz on March 15, 2025, 12:24:31 AM
My 9ja brothers and sisters, una shore say this economic crisis wey dey sup for our country go end? Because e com be like prices of things dey change morning, afternoon and evening...e kuku remain make we dey pay for the air wey we dey breath o, lol... cost of living wan kill the living for our country, abeg make una dey shear updates make everybody no turn armajiru enter streets.
Try shear update so we fit shear funds o, cuz our people Naim talk say one car no fit form convoy. Show love to people this period o, we go survive sha, on God.
Brotherly na Baba God go help us e con be like say person no dey hardworking enough. To feed sef na wahala, any way I believe in a better tomorrow where everything g done return to normalcy
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Agbe on March 16, 2025, 05:16:09 PM

Personally speaking speaking with all sincerity I don't personally see our economy getting better because the fact is that you don't wish and pray that an economy gets better because it's not by wishing that an economy will get better it's by hard work and economic programs that will be followed through and implemented, but in our case I don't see any signs of the Nigerian government doing that all we are doing is going to borrow money around the world we don't have any economic road map that we are following as a country every government that comes is coming with their own personal plans and after that government leaves you see everything that was put in place by the previous government been thrown away so Nigeria as a country is far from economic growth and stability
Title: Re: Wetin dey sup ?
Post by: Joeboy on March 26, 2025, 07:21:21 AM
My 9ja brothers and sisters, una shore say this economic crisis wey dey sup for our country go end? Because e com be like prices of things dey change morning, afternoon and evening...e kuku remain make we dey pay for the air wey we dey breath o, lol... cost of living wan kill the living for our country, abeg make una dey shear updates make everybody no turn armajiru enter streets.
Try shear update so we fit shear funds o, cuz our people Naim talk say one car no fit form convoy. Show love to people this period o, we go survive sha, on God.
Brotherly na Baba God go help us e con be like say person no dey hardworking enough. To feed sef na wahala, any way I believe in a better tomorrow where everything g done return to normalcy
Na wentin every Nigerians dey talk since, say na God go help Nigeria, but the question here be say will God really come down from heaven to help Nigeria, the answer is a big No. God na spirit and for him to operate in this physical realm he requires getting in contact with human beings who are physical beings and use them as an instrument to help people. But with the way the country is going the question is who will God use. See when most of our leaders are really self centered their concern is really not on the masses rather they are more concerned with enriching themselves and their family members. And we have a lot of our leaders who has this self centered nature. So judging from this can the country ever be better. This answer is for now No, unless there is a change later in the future.