Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: Maxwell99 on February 25, 2024, 07:01:05 AM

Title: We Nigeria are the cause of our problems
Post by: Maxwell99 on February 25, 2024, 07:01:05 AM
Wahala wen you see for this country so most of them na we dey cause am, even bad rulers na we still dey cauße am , e get wetin dey wrong with us for this country so called greed e too much, only you one benefits when dey very wrong so, how you go see say this person wen one rule no good because of money him give you go sell the whole country for people to suffer and you go dey complain later say thing's cost. We are too greed I swear, small dollar wen raise we increase fuel price even wen the dollar never high fuel price still dey up wetin na we we dey kill our sef no be lie, you go imagine say them go give you contract for your own community u no go do anything you go just leave the project chop the money then your community will be lacking good health care, education and road no be wickedness be that. The matter wen pain me pass na the one wen happen this few days so for custom you know custom dey hold goods for airport all those rice bag them hold so them decide to help we Nigeria by sell them cheap at the rate of 10,000 naira since things too cost. Many of us wen buy 10,000 still dey carry this rice bag dey go sell for 70k is that no wickedness and greed. How we want make the country take move forward with all this evil mind set wen we get. Like serious this matter pain reach ground, any one again them say education is free but we still dey pay school fees for all this government secondary school like the way private schools dey do and na very wrong thing before this country go better e go take the mercy of god.
Title: Re: We Nigeria are the cause of our problems
Post by: Cantsay on February 25, 2024, 05:44:58 PM
Bro, nor cex ooh but he go make sense if you still try Dey interact for threads wey you Dey create.

I don reply for some of your threads wey I feel day nor be spam and some I nor really see the need to reply for dem, but out those ones wey don receive replies e nor get anyone wey you as the Op don out mouth.

Not be to just Dey create thread ooh, still try talk one or two for the matter so that he go ginger others to give their own contribution for the mata.
Title: Re: We Nigeria are the cause of our problems
Post by: Maxwell99 on February 27, 2024, 12:13:12 AM
Bro, nor cex ooh but he go make sense if you still try Dey interact for threads wey you Dey create.

I don reply for some of your threads wey I feel day nor be spam and some I nor really see the need to reply for dem, but out those ones wey don receive replies e nor get anyone wey you as the Op don out mouth.

Not be to just Dey create thread ooh, still try talk one or two for the matter so that he go ginger others to give their own contribution for the mata.
Okay chairman I go dey engage and follow up replies and the rest of them so that the Nigeria forum go dey alive
Title: Re: We Nigeria are the cause of our problems
Post by: Maxwell99 on February 27, 2024, 12:14:38 AM
Bro, nor cex ooh but he go make sense if you still try Dey interact for threads wey you Dey create.

I don reply for some of your threads wey I feel day nor be spam and some I nor really see the need to reply for dem, but out those ones wey don receive replies e nor get anyone wey you as the Op don out mouth.

Not be to just Dey create thread ooh, still try talk one or two for the matter so that he go ginger others to give their own contribution for the mata.
Okay chairman I go dey engage and follow up replies and the rest of them so that the Nigeria forum go dey alive because most of us dey busy for other forum, as I see say this Nigeria forum people no too dey active like the rest forums
Title: Re: We Nigeria are the cause of our problems
Post by: Gormicsta on April 04, 2024, 04:50:40 AM
Of course, we are really the cause of our problems, yet we dey put am for government head or say dollar don rise, even now wey be say dollar don drop, we still dey complain say dollar don rise, we just dey carry our hand dey cause why things dey very very high, na the traders just dey increase everything, dey go just increase am like to get money easy, dem dey follow dey help why people dey suffer, and government supposed put mouth for this matter o, because e no really dey easy for person, and make we been customers understand say we get right to decide who to buy from or not, if person dey sell things cost, we go go the other person just to find who dey sell less, in that case, there body go come down, like that we fit dey help ourselves if government no dey help because the way the country dey no be to dey, dey behave mumu. We need to wise and stand foe our rights.
Title: Re: We Nigeria are the cause of our problems
Post by: Rruchi man on April 05, 2024, 12:36:51 AM
~
There is a lot of disunity among Nigerians, and this has been promoted by the government to ensure that it becomes difficult for everyone to act as one. Asides the government making things difficult for us, any Nigerian that has an opportunity over others makes sure that they consider only their benefit and that of their family. This is why we have not been able to as one Nigerians bring change to our country, and also why a simple trader in the market will refuse to bring down the cost of their goods even when the exchange rate which they claimed was the reason for increment has dropped.