Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: Mr. Allcrypto on February 27, 2024, 11:23:33 PM

Title: 9ja make we gather here
Post by: Mr. Allcrypto on February 27, 2024, 11:23:33 PM
Wetin we go do for the country as e don be say every where don cast like this, price of things sef don turn to something else, I smoke when I go store today to buy something when another small girl come buy 20leaves 200naira, ahhh 9ja make e no bad pass like this o if not the youths for our society go de involve in illegal means to get money.
Talk wetin dey your mind make we reason am together...
Title: Re: 9ja make we gather here
Post by: DragonF on February 28, 2024, 02:02:32 PM
Our youths don dey involve for illegal already and e go continue becos things no be like wetin wan beta soon. Rituals don dey too much and na so people dey die like rat in fact currently rat dey live long pass human being. Make I share wetin happen to me yesterday. I buy indomie super park for #300 yesterday in the morning but wetin shock me na say wen I go back in the evening the woman tell me say na #350 now. I shock oh. e make me buy minimie noodles becos na wetin my money fit afford.
Title: Re: 9ja make we gather here
Post by: Mr. Allcrypto on February 28, 2024, 09:28:16 PM
Our youths don dey involve for illegal already and e go continue becos things no be like wetin wan beta soon. Rituals don dey too much and na so people dey die like rat in fact currently rat dey live long pass human being. Make I share wetin happen to me yesterday. I buy indomie super park for #300 yesterday in the morning but wetin shock me na say wen I go back in the evening the woman tell me say na #350 now. I shock oh. e make me buy minimie noodles becos na wetin my money fit afford.


And these once na things wey the government sulpose consider, baba for my area super pack pass #350 sef, and the cost of living wan kill the living...lol 9ja fon scatter, instead of them to handle this matter them go dey do matters wey no even matter, e shock me to see say Nigeria P2p no even dey for binance again, 9ja wetin de sup???