Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: MOProgress on December 12, 2018, 01:22:56 PM

Title: Na Where All The Whale Dem Dey Sef?
Post by: MOProgress on December 12, 2018, 01:22:56 PM
I only dey hear of whales, and I see some last year for 2017, but since did year, I never see any dolphins not to talk of whales, abeg I wan ask, where the whales go?
Title: Re: Na Where All The Whale Dem Dey Sef?
Post by: Stuart on December 12, 2018, 03:11:16 PM
I only dey hear of whales, and I see some last year for 2017, but since did year, I never see any dolphins not to talk of whales, abeg I wan ask, where the whales go?

Lolzz, em say dolphin.
It is better make them hide themselves oh, only one I hear of cus wahala for market til now.

Before the price of bitcoin go below $4,500, news from CMC app, give me update say one whale drop 90% of em coins to the market, since that time na I see the price come de below $4,500 to $3,800 - $3,900. So, I come de wounded, if two or three drop their own, how e oh come be na?
Title: Re: Na Where All The Whale Dem Dey Sef?
Post by: PRIBO247 on December 12, 2018, 10:09:10 PM
Abeg make dem dey wia dem dey o! We no need dia wahala.
Title: Re: Na Where All The Whale Dem Dey Sef?
Post by: Stuart on December 13, 2018, 08:59:26 PM
Abeg make dem dey wia dem dey o! We no need dia wahala.

I support you oh broad, if only one do this kin tin, how e oh come be if 5 - 10 of them do the same. Make them just de one side first abeg.
Title: Re: Na Where All The Whale Dem Dey Sef?
Post by: MOProgress on December 14, 2018, 10:58:16 AM
Abeg make dem dey wia dem dey o! We no need dia wahala.

You mean wetin you talk so abi you just talk am? Person like me I need their wahala here, make at least the prices of the market go up small.
Title: Re: Na Where All The Whale Dem Dey Sef?
Post by: PRIBO247 on December 17, 2018, 05:07:45 PM
prices go up for wia? Only one just dump nah him prices turn to stone way dey fall down!
Title: Re: Na Where All The Whale Dem Dey Sef?
Post by: Stuart on December 18, 2018, 01:56:26 PM
Abeg make dem dey wia dem dey o! We no need dia wahala.

You mean wetin you talk so abi you just talk am? Person like me I need their wahala here, make at least the prices of the market go up small.

Broad, you fit make your point clearer? If only one out of all the whales wey de, drop over 90% of em holdings for the market, market crash like this, how e oh be when others drop their own?
If you de think say them oh buy more, I nor sure say that one oh happen soon oh. Who know if them too nor de expect waytin de happen now for the market.
For me, make the market recover by emself, not by the whales.