Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: MOProgress on December 12, 2018, 01:29:10 PM

Title: How Many Coins Naija People Be Their Dev?
Post by: MOProgress on December 12, 2018, 01:29:10 PM
I always dey wonda for something, I know say Naija People Get Some Coins, but I wan know, how many coins Naija people be their developer weh dey do wella?
Title: Re: How Many Coins Naija People Be Their Dev?
Post by: Stuart on December 12, 2018, 02:53:05 PM
I always dey wonda for something, I know say Naija People Get Some Coins, but I wan know, how many coins Naija people be their developer weh dey do wella?

For me I nor really know oh. But e get one ICO way de on now, na Nigerian project based here for Naija, I sure say na Nigerians oh be de developers for the project and maybe with some white them.
Title: Re: How Many Coins Naija People Be Their Dev?
Post by: PRIBO247 on December 12, 2018, 10:13:17 PM
I no folo 4 any project wey naija put hand inside. Dia gbegeru too much.
Title: Re: How Many Coins Naija People Be Their Dev?
Post by: Stuart on December 13, 2018, 08:56:26 PM
I no folo 4 any project wey naija put hand inside. Dia gbegeru too much.

Hahaha, see this man. Naija wan make move too for technology na, or u want make we remain backwards? Anyhow e oh be, we oh still support them.
Title: Re: How Many Coins Naija People Be Their Dev?
Post by: MOProgress on December 14, 2018, 10:39:17 AM
I no folo 4 any project wey naija put hand inside. Dia gbegeru too much.

Hahaha, so you even dey fear your own people too? But the truth be say Naija de very funny sha, anything fit happen here. But Naija na still the best!