Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: MOProgress on December 19, 2018, 08:23:59 AM

Title: Yes! E Don Happen!
Post by: MOProgress on December 19, 2018, 08:23:59 AM
So finally we don dey official for this forum, dem don remove us from that small other languages come make us official, I happy for this one.
Title: Re: Yes! E Don Happen!
Post by: Stuart on December 19, 2018, 09:02:16 PM
Me, I follow happy, now na for we to come this section make em de more active, so that campaigns oh fit de come here, and that one oh make us more popular too.
Title: Re: Yes! E Don Happen!
Post by: MOProgress on December 21, 2018, 07:09:00 AM
Me, I follow happy, now na for we to come this section make em de more active, so that campaigns oh fit de come here, and that one oh make us more popular too.

This na true talk, the thing be say, we go do small evangelism make we let all our Naija people to come join us here, for us to dey more relevant.
Title: Re: Yes! E Don Happen!
Post by: Stuart on December 21, 2018, 08:23:19 AM
Me, I follow happy, now na for we to come this section make em de more active, so that campaigns oh fit de come here, and that one oh make us more popular too.

This na true talk, the thing be say, we go do small evangelism make we let all our Naija people to come join us here, for us to dey more relevant.

How you tink say the evangelism oh be, becuz rules de this forum oh, and na so penalties follow am. So, if you know how this evangelism oh fit take hold, we fit reason am together.
Title: Re: Yes! E Don Happen!
Post by: PRIBO247 on December 21, 2018, 09:55:43 PM
Shey una know say nah we three nah him do dis place come lively so tay oga admin no come get choice but to move us to beta section? Abeg make we give ourselves beta gbosa first before we dey talk of evangelism.
Title: Re: Yes! E Don Happen!
Post by: Stuart on December 26, 2018, 03:10:43 AM
Shey una know say nah we three nah him do dis place come lively so tay oga admin no come get choice but to move us to beta section? Abeg make we give ourselves beta gbosa first before we dey talk of evangelism.

Na so my broad, we really need that gbosa for away self.
Maybe by 2019, more people oh join us, then see say this section don de get hands, becuz Naija bobbus isa joke.
Title: Re: Yes! E Don Happen!
Post by: tonymillions84 on February 05, 2019, 03:40:16 PM
omo you na legend. nobi today. kudos to you for being one of the chief.