Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: PRIBO247 on December 21, 2018, 09:46:41 PM

Title: Between Cash And Crypto Asset, Choose One
Post by: PRIBO247 on December 21, 2018, 09:46:41 PM
For this Xmas, everybody just dey jolificate. Dem dey look forward to relaxing and getting some small small gifts dem. If among the gifts you wan get for this Xmas, person tell you to choose between cash and crypto asset, nah which one you go take?
Title: Re: Between Cash And Crypto Asset, Choose One
Post by: Stuart on December 26, 2018, 03:26:57 AM
Except say the person way wan give out the gift, de only give people wey nor know anytin about crypto. Personally, na crypto asset, becuz say, na em oh fit born pikin wey oh grow shap shap, for cash, e oh finish even at that time wey e de enter hand. Unless say I need cash well well oh, otherwise, na crypto asset.
Merry Christmas to Naija people.
Title: Re: Between Cash And Crypto Asset, Choose One
Post by: Klassifiednero on January 04, 2019, 04:09:09 AM
I fit collect anyone o.. all of them depends on the value of the gift wey I wan collect, if the cash plenty pass the crypto asset, I no go waste time at all to collect cash, but if na the same value them be, I fit go for crypto asset depending on how the market dey move for that time
Title: Re: Between Cash And Crypto Asset, Choose One
Post by: Abiodun on January 07, 2019, 10:43:05 AM
Cash dey important, but CRYPTO assets dey importanter, I prefer CRYPTO assets because at the long run the returns dey always dey massive
Title: Re: Between Cash And Crypto Asset, Choose One
Post by: PRIBO247 on January 14, 2019, 09:12:35 PM
I fit collect anyone o.. all of them depends on the value of the gift wey I wan collect, if the cash plenty pass the crypto asset, I no go waste time at all to collect cash, but if na the same value them be, I fit go for crypto asset depending on how the market dey move for that time

My broda u sabi d koko!

Cash dey important, but CRYPTO assets dey importanter, I prefer CRYPTO assets because at the long run the returns dey always dey massive

oh men dis one importanter gada serious weight!
Title: Re: Between Cash And Crypto Asset, Choose One
Post by: Stuart on January 18, 2019, 02:13:51 AM
What if say the two of them na the same price. For example, #100,000 NGN and the same amount for BTC. For me, if I nor get any matter for hand to settle, I oh go for crypto.