Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: MOProgress on January 10, 2019, 07:12:20 AM

Title: What If Dem Stop Crypto?
Post by: MOProgress on January 10, 2019, 07:12:20 AM
I just dey wonder about something did morning, just imagine say dem stop cryptocurrency business worldwide today, wetin you go do?
Title: Re: What If Dem Stop Crypto?
Post by: Stuart on January 10, 2019, 07:50:21 AM
Lolzzz. I nor sure say the government of America oh fit stop am, even the G8 countries sef. Crypto currencies nor de under anybody management or control, except say na for countries wey dem don de use am to buy things. If them stop am for the country, e nor mean say person nor oh fit use am for internet, because na internet money.
Title: Re: What If Dem Stop Crypto?
Post by: tonymillions84 on February 24, 2019, 11:49:17 PM
baba you have no choice than to leave pass. na only be  continue with your formal employers.
Title: Re: What If Dem Stop Crypto?
Post by: Abiodun on March 05, 2019, 11:09:20 PM
Bros, unless them stop internet totally na him go make them fit  stop cryptocurrency, crypto currency in the next 5 - 10 years go be a very big thing in the world and we the early adopters go enjoy am at the longrun. Meanwhile many countries Don they legalize am, and many good news still dey come..
Title: Re: What If Dem Stop Crypto?
Post by: Fatiti on March 07, 2019, 09:30:50 AM
Lolz, this question Sha, just as abiodun talk so, I no think say them go fit scrap crypto and thats why dem dey call am decentralized currency which means say anybody no fit just come scrap am unless internet no dey again.
Title: Re: What If Dem Stop Crypto?
Post by: Stuart on March 07, 2019, 06:28:03 PM
Lolz, this question Sha, just as abiodun talk so, I no think say them go fit scrap crypto and thats why dem dey call am decentralized currency which means say anybody no fit just come scrap am unless internet no dey again.

And crypto too small to be the reason way oh make internet nor de again. Big countries now de rely for the internet, militries, researchers and plenty other things them and people too. So nothings about internet oh stop anytime soon.
Title: Re: What If Dem Stop Crypto?
Post by: tonymillions84 on March 22, 2019, 11:43:48 PM
we go back to our normal ponzi business naa. anything is possible. oyibo fit wake and decides to clamp down any thing way be crypto. na them know best. so if they do , we get no choice to go back to our ponzi system.
Title: Re: What If Dem Stop Crypto?
Post by: Abiodun on March 24, 2019, 07:20:24 PM
I no believe say, them go fit scrap crypto oo, the way nations dey involve for the stuff no be here ooo... and that why dem dey call am decentralized economy which mean say govt or any body or organization no fit just scrap am like that.
Title: Re: What If Dem Stop Crypto?
Post by: Fatiti on March 30, 2019, 03:46:07 PM
Many industries dey key into cryptocurrencies industries, because them know say the technology get potentials and as such cryto no fit die just like that because e Don dey, dey relevant to the entire world.
Title: Re: What If Dem Stop Crypto?
Post by: Abiodun on April 02, 2019, 04:21:51 PM
I know say with the innovation of this blockchain technology..life go dey more easier and transparent for us in all ramifications of our lives...
Title: Re: What If Dem Stop Crypto?
Post by: Stuart on April 02, 2019, 10:38:14 PM
JP Morgan way been de bring the leg say bitcoin and all other crypto currencies na bubble and scam, em son come up with em own crypto campaign. And I de sure say that one oh make more people get confidence say crypto oh de genue and countries nor oh ban am.
For example;
USDT, USDC these two coins na America own (as per dollars) and them want a stable market, where loses nor oh de or small....which means them done accept the use, so, who wan come stop crypto....no one.
Title: Re: What If Dem Stop Crypto?
Post by: Abiodun on April 05, 2019, 05:33:32 PM

I know say this people just dey use strategies to make people no believe in this CRYPTO currencies stuff so that them go fit use opportunity to park everything leaving leveraging on the fact that dey no want make other people rich..
Title: Re: What If Dem Stop Crypto?
Post by: Fatiti on April 06, 2019, 06:21:07 PM
No be like you talk brother, the thing be say make we just dey main our ground always because if we no maintain our group we go end up looking if we dey falling all this rich people callings..
Title: Re: What If Dem Stop Crypto?
Post by: Abiodun on April 07, 2019, 04:26:01 PM
No be like you talk brother, the thing be say make we just dey main our ground always because if we no maintain our group we go end up looking if we dey falling all this rich people callings..
You self na true you talk we just need dey do our own things in our own different ways so the we no go miss out on Wetin we don't start for a while now.