Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: Stuart on January 29, 2019, 08:05:54 AM

Title: who de play us behind the scene?
Post by: Stuart on January 29, 2019, 08:05:54 AM
Who you think say e de responsible for the wahala way de market de face now?
U tink say na Exchanges, Miners, Whales or na articles way full the net? Which one we oh hold for waytin de ground.
Title: Re: who de play us behind the scene?
Post by: tonymillions84 on February 07, 2019, 01:02:56 PM
Miners no get say but them sabi flood market with tokens. i no blame them. its free. the people wey dey write articles na attention dem dey look for. it is risky been a whale. you might get broke.
Title: Re: who de play us behind the scene?
Post by: Fatiti on March 07, 2019, 09:36:27 AM
Bros Stuart, I believe say na whales dey spoil this market oo, na them dey make the market no stable at all, and all this things go stop if SEC fit regulate cryptocurrencies at least this manipulation go stop to some extent.
Title: Re: who de play us behind the scene?
Post by: tonymillions84 on March 22, 2019, 11:45:43 PM
Na whales oo. na them dey control the market with bitcoins. i don notice serval times that once bitcoin price raise, other coins go raise but once it fails, na kasala for everywhere. na those oga dem way carry plenty bitcoins na dem dey control the market.
Title: Re: who de play us behind the scene?
Post by: Abiodun on March 23, 2019, 12:48:14 PM
Na whales dey contribute to either the positive or negative part of the market na them know how the market dey go, na them dey always influence market, so I believe say na them be the major contributor to the market as a whole.