16
Off topic & Sports / Cement price on Bullrun
« on: February 20, 2024, 08:15:21 AM »
Una gudi more mor abeg wetin I dey hear for cement price na true?
Yesterday evening for service as our Bishop dey talk project him cun say em dey pity those people wey dey always procrastinate over their project because of the way building materials dey increased on a regular basis.
Him come say if we get any person wey get project for hand or anything wey them wan do for this time say make dem speeding because things go still heck pass like this, also take for instance dollars to Naira is about 1720 per USD so things go still increase.
Even as I go market my dear e no easy things wey I been dey use 10k to 20k buy then but now e no fit again even though I buy na just few things I go successfully buy and I come back home begin dey run my brain on wetin I really buy with those money. E pain me like say tomorrow no dey, transportation na worst since them say petrol na 800 per litter I no know how authentic this information be.
Abeg how una dey cope with una families especially those of una wey get upto 2 to 5 how una dey take feed for house.