556
Nigerian Languages / Re: [Info]Naira Scarcity and BTC Mempool Congestion. How una dey survive?
« on: January 13, 2024, 02:57:12 PM »December been choke because of the congestion and fees during the time be like say e reach times two.Ordinals come use style bring one kind hardship for we bitcoiners because you get bitcoin to sell cash out small funds to use hold body, e go turn to India fee because of high transaction fee based on the mempool congestion. If you be person wey no fit take the pain risk the high fee, na so your transaction go dey for the mempool because no miner to add am to the next block for confirmation. I no fit cry on the 28th wey I suppose travel my Btc transaction disappoint me and I just dey house dey try ViaBTC accelerator to see whether e go dey possible for me to add am join their free 100 transaction but no way. Na till on 30th na e I come fit travel. If una see the joy wey dey my body say my coins show for CEX, e be like say I win jackpot. As I dey so, I still get one transaction for my local wey never confirm for two weeks now but wetin I won do nothing, as I dey wait patiently for any mempool to add the transaction back to their next block. Ordinals make bitcoin transactions dey vex person.
I no know why things dey always dey harder when December or such kind of celebration season reach.
I know the kind small hell wey I see and as I been dey tell my friend, ordinals and most of the new projects on Blockchain dey very contributory to the palava of memepool congestion and hike in transaction fees.