For those only teleporting to this forum today or this week, I've been here since Jan 2021, posted a few times but dey activities as of that time be no too gel as of now and with the whole censorship on BTT we hope we can build up another active community for here as we run am for that side.
I wan make we outline for dey do our thing, the admin dey very friendly and active and most of the things wey theymos denied us we go get am for here the way everything is setup here.
Abeg my people make una represent for this thread make we dey go jejely.
My brother my friend I thank you for this thread where you carry enter here for we to put month as in me sef dey among first people to register back then, but you know how new something dey be na, inactivity come make me lose out on few things and development as it concern this forum and beside me be no even dey active for both forum then.
But now we're reggae done dey change to blues, na so me put eye back here make I see waiten dey happen for here, I come see say my men done full ground for here dey make thing happen already and I commend you guys for that let make this forum more active.