61
Nigerian Languages / Re: Make una try dey active
« on: December 15, 2023, 09:48:55 PM »Dis na my first post for this forum and as I join I say make I come align with my local community. Upon coming here, I see say d board no too dey very active and many posts don dey wey no activity don dey. I get knowledge about altcoin but I say make I come join here to share ideas with more people wey get interest for cryptocurrency like me so dat we go brainstorm together. Wuna all welldone.
E shock me too o as I see Naija board dey dry like this, we all know sey Naija no dey carry last why we wan come carry last for here na? When I joined this forum, I con go read the forum rules and the next place I start to look for na our Naija board because I know things dey always happen for where Naija people dey.
Sha I know sey wan day we go top all the other boards, but if we no start am now when we go con start?