With de wey hunger and inflation dey do partnership 4 dis country, even de hardworking self don dey tire 4 de mata. 500naira no b 500naira again, 1000naira no be 1000naira again. If u fit chop 3 square meal everyday, den u join de piple wey dey live another life 4 wi country. Na y i dey salute all hardworking piple, especially those wey dey hustle, cum still dey invest sum portion of their hustle 4 Bitcoin or others.
I remember watin sup last month, wen hunger finally reach de maximum height. I literally had nothing on me at dat moment. No b joke, bcus nothing dey 2 put 4 belle. At dat critical point, de only tine wey my mind fit fall back 2 na my crypto portfolio. Unto say i dey do HODL for most of dem, I tried denying myself from touching it. After contemplating 4 long, and i realize say na who dey alive dey do investment, i sharply sell sum take reduce de maximum height of de hunger. The mata no funny at all, because na sumtine wey anybody no go like experience.
In conclusion: After getting money from other source, I replaced de coin wey i sell sharply. Omo, de backup was indeed a sure backup. Christmas don reach, and i sure say some piple don dey do their mind. Definitely man must chop!!, man must survive!!.
Thanks for reading, and do well to drop a comment and also share ur experience if u av one.
True talk. Crypto na still one of the most sharpest investment wey person fit enter into for this country, considering the way naira just dey loose value. If pesin Sabi the game wella and him no dey greedy, e fit really turn around your story.
But make we no lie e no be fast money. E get how the market go take dey volatile, and if person no get sense, him fit loose everything. Na why I dey always tell people say make Dem learn am wella before dey put their money, make them no just follow the hype .
Still if you play am smart, e fit be your way out.