Omo many traders for this crypto space go fit relate.Stress dey trading mani pipo make dey think Shey online trading easy omo nor easy at all mostly make u get poor risk management. Some time e get some loss make you go loss ehn body go tell u through process mood swing go fit come seff, so those Una make still dey think shey trading get rich quick scheme, nothing like that e dey take time and principles to be a successful trader.
Well nothing for this life dey easy like wise trading ,to be successful in crypto trading one needs learn so many things in regards to trading in other to be successful morespecially timing the market to know when u go buy or to sell ,risk is involve in trading so ones need high risk tolerance and is always adviceable not to trade with the amount wey u no fit afford to loose.why people dey see trading as get rich quick scheme is becomes most of de trade dey look for quick money from trading ,them go invest for crypto before you know them don go trade and dey will be expecting to make big profit from it. so me i go advise all investor not to quick rush to sell or trade there crypto, because dey will make more profit from long term investment compare to short term.