I don check using Google search to see weda Kuda bank don get any issue recently wey go make dem no dey for Binance exchange, and I no see anything. I no dey use Kuda bank and there is no way I fit check at my own side. I been dey reason say e fit be network issue because Binance no go just stop to accept a particular bank for no good reason. But Cantsay last explanation make sense, and e fit be the reason why Kuda bank account no show up as you want run transaction.
This matter no really be as you talk from the initial point of view. Initially I been dey think say Padi men dem don cast things for binance wey make me think say binance don blacklist Kuda from trading with dem but however, after I don read through to see things for myself with other comments and replies, I don understand wetin dey sup for the system.
Kuda tanda for myself, no shaking, me no dey use Kuda, but I don search through my binance p2p account and I see alot of traders wey ready to buy or sell through Kuda, me self con take style do as if I won add Kuda for my list of trading accounts, and binance open form gidigba for me to put in my Kuda account details, that one show say binance no blacklist Kuda at all, so the issue fit be from your end.
And from your comment above, e be like say you don smell the rat where e dey smell, e for good if you yarn us the latest, wetin con make am be like say binance remove your Kuda account? Make you tell us so that incase if na mistake wey you make, others go try not to make same mistake.