This betting stuff na by luck oo no be say them go give game and e must enter na them dey play the match. Even the owner of betking no get sure game for person to take chop na ur prediction matters these days I no know weda our economy follow affect our tickets no matter how u play, if u like play all players to wear boot person go still go wear slippers enter pitch na so the game Dom hard Omo economy hard oo no be for only naija but everywhere so different strategies dey to take banter gamblers.
From my own experience, when I been dey handle lotto machine I hope say na popular thing for naija na I dey my stand one day naim one man blow motor come park for my place that man sit-down talk with me till results come out and this man I Neva see am before oo, when I come print the results this man shout chai this woman don chop I say who him say person wey him give game say na 300k my head big him make call the woman say na true say she Dom chop. Him tell me say u see this new game now so so so game go play and him show me very sweet calculation I fall.
Him say if u get 6k carry 3k play oo I say ok, him say but before I go give u the number u go play my own 3k too that is 6k I say I no get money him say make I call person wey get money I call one woman she come, my very strong customer this woman play her own and the man 6k when them play finish them exchange numbers the man go results come out one number sef no show this woman call the man till today switched off. When person come wey I tell am wetin happen him describe the man I say yes him say na lotto office employ agents them dey persuade people to play them even give them motor to carry dey go different places all this calls na plan with others. So gamblers be careful nobody be destined gambler use ur head make them no deceive u though luck dey them fit give you e enter no mean say him dey there wen them play the game. Thank you.