Nor be only for Naija board he for Dey run am ooh - I just check he post history and I notice say he still Dey make those kind posts for other boards too.
From around 4:41 am to 7:41 am today, this account don already post up to 25 posts and nah morning we Dey ooh, afternoon never reach meaning he fit even drop more than 100 posts in a day if he wants to.
Sometimes na so e dey be wan person no wan read rules and regulations wey governed the forum and when e pass like this na ban them fit ban onto say him feels say this forum no strong like other place, but wait o could it be that op dey weed before him come post here because Norma person no fit dey rush post like that abi him na robot?
E dey possible day the dude fit dey chase after some badge award, like this one way I screenshot and share below..

That na the "too active" badge, to get this badge, you have to make 25 posts in one day, I remember the day wey me decide to win this badge, that was sometime in September 2020, I spam the forum that day, no small, just for me to able to make 25 posts, I achieve am las Las Sha, even though say e no dey come with any benefit.
All in all Sha, admin don suppose remove this type of badges, because some users may decide to chase after it to earn it, and in that process, they go end up spamming.
I go post about this for forum matters later.