Honestly, me choose say na we be witch to ourselves, I mean, we Nigerians dey contribute greatly to this forum, our posts and comments dey always make sense, but then, we no dey earn the positive Karma wey suppose follow, e come be like say to earn merit for bitcointalk come dey easier than to earn karma for this forum, even upon say karma na free, which means say, we no need to have positive Karma to give it, like we need to have smerit to give merit on btt.
Na we dey biwitch ourselves, me dey always try to Karma every good post wey I see, but in return, others no dey karma me, and the thing dey sometimes discourage me from continuing to Karma others, positive Karma na something we no suppose dey stingy ourselves of, because na free to give it, but as e be, I no con understand again I swear 🤔
I knw sey na senior members and above they give karma and I dey always think sey if dey award karma to others dem dey deduct am from dere own na now I just dey know sey e no dey like dat.
I know sey karma no be every post dem dey award to it base on your contribution to forum dey go give you.
We wey be newbies na karma be our encouragement for here anytime wey we see sey we make good contribution. when I join dis forum na dis our Naija board I dey always post and dey no dey encourage us with karma, because I believe sey most of my karma na for other boards I get am no be here.
We wey dey put effort to make dis our board active make dem encourage us.
My brother, there is absolutely now way wey you fit know where, which board or person wey give you karma, except the person reply to your post con mention for him or her comment say he or she give you karma, just like I give you one positive Karma now, and you no fit know except as I tell you now.
So, as e be, no just conclude say na from other boards you dey get your karma from, our Nigerian brothers and sisters for here wey don Sabi how the Karma system works dey try their best, disregarding say some still dey f*ck up.