As I see say watin I wan yarn nah exactly the same with this topic nai make me nor just both deh create new thread.
The matter Wey I bring come make we put mouth nah concerning the $10 billion dollars fine Wey we Government don slam for Binance head.
I believe say majority of us don't already hear the news, and some of us don't already locate other exchanges weu still get naira for their p2p system but the issue now be say what if binance decides to close all accounts Wey run Nigeria KYC? He get some people for Naija when he be day all their coins nah binance dem dey keep am, if something like this sup how dem go waka? I just dey reason am since when I come across that news, Abi he nor dey possible for binance to block all Nigerian kyced account?
Abeg made Una shook mouth for the matter small make I hear wetin Una get to talk for the Mata.