Altcoins Talks - Cryptocurrency Forum

Local => Nigerian Languages => Topic started by: tonymillions84 on April 25, 2019, 01:06:42 AM

Title: crypto in Niaja
Post by: tonymillions84 on April 25, 2019, 01:06:42 AM
aBEG UNA GET ANY SHOP, MARKETS OR OUTLETS WEY DEY ACCEPT BITCOINS OR ALTCOINS FOR NIAJA. Na we market this crypto pass oo. i no understand why we nevver get better crypto market.
Title: Re: crypto in Niaja
Post by: Stuart on April 25, 2019, 04:21:30 AM
I nor sure say for now, any market of such done de for Naija. Maybe time to come, we oh get one.
Title: Re: crypto in Niaja
Post by: Abiodun on April 25, 2019, 10:53:04 PM
aBEG UNA GET ANY SHOP, MARKETS OR OUTLETS WEY DEY ACCEPT BITCOINS OR ALTCOINS FOR NIAJA. Na we market this crypto pass oo. i no understand why we nevver get better crypto market.
I no think say Nigeria fit get CRYPTO exchanges for now because we never get the standards at  all untill we fit start to dey, dey sincere to our self's before people go fit entrust there funds with us...
Title: Re: crypto in Niaja
Post by: tonymillions84 on April 26, 2019, 10:43:49 PM
echanges don dey for niaja. quidax don enter niaja, binance want come to. i doubt if luno go give them space because luno dey dominate everywhere for africa.  luno na south africa exchange. we never get any strong back up maybe finance or security.
Title: Re: crypto in Niaja
Post by: Abiodun on April 28, 2019, 12:10:32 AM
echanges don dey for niaja. quidax don enter niaja, binance want come to. i doubt if luno go give them space because luno dey dominate everywhere for africa.  luno na south africa exchange. we never get any strong back up maybe finance or security.
Bros Wetin him mean be say, him dey talk about exchanges wet a Nigerian or Nigerians own, the one we them Creat from naija,  I no think say Naija go get any exchanger soon because of our mentalities..